UK visas and immigration: Goment go unveil big immigration plans on Monday - how e go take affect immigrants? - BBC News Pidgin
Wia dis foto come from, Getty Images
Secretary of State for di UK Home Department, Yvette Cooper don dey get ready to unveil di goment changes to di rules wey go determine who fit come to di UK wit permission, and for how long.
Her White Paper, wey she go call "Restoring Control Over the Immigration System" and wey go be 69 pages, na big moment for Labour to try to sort a messy system, under which di numbers of pipo wey dey move to di kontri rise above many pipo imagination.
As Reform UK wey be rival political party dey capitalise on public concern about immigration, di success or failure of Cooper dey important to di goment.
E go dey clear in full on Monday 12 May, but we sabi a lot about wetin dey on di table.
E dey expected say work visas go dey strictly time-limited for jobs wey no need graduate-level skills.
Skip Di one wey oda users dey read well well and continue reading
End of Di one wey oda users dey read well well
Foreign students wey don study for degrees for UK fit lose di right to stay for di kontri afta dem finish dia university studies.
Overseas workers go dey expected to get better understanding of English, but reported suggestions of A-level equivalent no correct.
And companies wey repeatedly no fit show efforts to recruit UK-based staff, rather dan hunt abroad, fit lose dia right to sponsor foreign workers to enta UK at all.
E dey likely say proposal wey dey designed to change how judges dey apply wetin dey known as Article 8 of di Human Rights Act, go dey. E dey designed to protect evri pesin right to a family life.
But how immigration lawyers dey use am sometimes to stop deportations don be concern of politicians - for 2011, I even remember Theresa May dey say asylum seeker don dey allowed to stay for UK becos of dia cat.
More dan ten years later, recent cases like dis one wey dem raise at Prime Minister's Questions don lead di goment to review how di courts don dey interpret evri pesin right to a family life. We go hear more of di details from di home secretary for studio tomorrow, and likely from di prime minister on Monday.
Some Conservatives and Reform argue say di only way to make difference na to leave di European Convention on Human Rights, instead of ministers to dey stick dia nose into di courts. Weda di goment proposal here make difference, we go see.
Wia dis foto come from, Getty Images
But di big principle in Cooper thinking na say di immigration system gatz dey fundamentally linked to di labour market - helping British workers to get di skills to fill vacancies, instead of to bring overseas workers again and again, to plug di gaps.
Di Whitehall wiring go dey redirected to try to make dat happun wit a new approach under a 'quad' - wia employers, di Department for Work and Pensions, di job centre, skill bodies, and di Migration Advisory Committee, wey dey set di specific rules, go all work togeda.
One Cabinet minister say di last time Labour bin dey for power, wen "pipo bin raise concerns, e bin dey too easy to say na race question – good understanding dey now say good, decent pipo dey worry about immigration – na about fairness".
Wen report show say na 900,000 pipo bin come to di UK for 2023, di prime minister hold emergency press conference and accuse di Tories of failed "open border experiment".
One senior goment source say now di previous goment bin no "bring in 100,000 scientists to live in central London, e bin dey bring in pipo to fix problems of di economy evriwia, often for poor communities".
Ministers accept say need fit always dey for overseas staff wit specific expertise to come to di UK. But Sir Keir Starmer allies say e don dey make di case for years, since one speech to di CBI for 2022, wey warn employers say dem no go dey able to rely on cheap foreign labour on im watch.
Since den, partly down to di Conservatives tightening up of visa rules bifor dem leave office, di number of pipo wey dey come to di UK legally don drop a lot and e dey expected to fall further dis year. But di political prominence of di issue overall don go di oda way.
By some polling measures for spring dis year, immigration and small boats pass di NHS as di biggest worry for voters for 2025.
Sources inside di goment accept say for many of di public, di issue of legal and illegal migration dey bundled togeda.
While legal migration don dey fall, di number of dose wey dey enta in ways wey dey considered as illegal and trying to claim asylum don go di oda way, as e hit di highest level since 1979.
And na two highly visible signs dey - small boat crossings, and asylum seekers wey dem dey house for hotels around di kontri.
One member of di goment bin tell me say, "Na di boats, and evritin dey amplified on social media, we know e dey get effect as dem dey feed am back to us on di doorstep - as a party, we just dey flounder".
Di use of hotels no only dey costly - projected recently to be £15bn, times three di amount di Conservatives bin establish by calculation wen dem sign di contracts back in 2019 – dem fit also create unease and resentment in communities.
One Labour MP wit asylum hotel for dia constituency tell me say a big part of di problem be say constituents link spending on hotels wit di goment squeezing cash elsewia.
"E dey impossible to make di case say we need to do some form of austerity while we dey spend so much money on putting pipo up here – weda na winter fuel and PIP (welfare payments) – you no got money for dis, but you get money for that."
Belief even dey for Downing Street say if asylum hotel no dey for Runcorn, Labour fit still retain dia seat for di by election last week.
Di oda blindingly obvious reason immigration don become so fraught politically na sake of say for many years, different goments don tell di one thing but do anoda. Under Tony Blair, pipo from kontris wey dey join di EU bin dey allowed immediately to come and work for UK.
Di goment bin publicly estimate di numbers likely to move go dey around 13,000, but hundreds of thousands of pipo from Eastern Europe make di UK dia home in di following years. Papers wey dem release at di end of last year reveal say some of Blair team bin worry precisely about dat happening.
David Cameron den promise repeatedly say im go get di number of extra pipo settling for di UK under 100,000. E repeatedly break dat vow. Im goment lack of ability to control migration from Europe bin dey at di core of di Brexit argument.
Wit deep irony, Boris Johnson bin win dat argument for referendum, den set up one immigration system wey bin allow even more pipo to move to di UK, peaking at 900,000 for 2023. Rishi Sunak den promised to "Stop di Boats" - but dem still come.
One No 10 insider say di "public don dey gaslit for years – dem don tell taxpayers say e dey happun, but nothing don change".