King Charles III visits Cartwright Hall, art gallery and community cultural space for Bradford, England on 15 May 2025.

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, The King is now estimated to be worth £270m more than his late mother the Queen

Di number of UK billionaires don fall while King Charles personal wealth don jump to equal former prime minister Rishi Sunak and im wife Akshata Murty, according to di latest Sunday Times Rich List.

Di annual list of di UK 350 richest people reveal di biggest decline in billionaires for di paper history.

Meanwhile in di past year, di King wealth don grow by £30m to £640m, increasing im rank 20 places to 258 with Sunak and Murty.

Topping di list for di fourth consecutive year na di Hinduja family behind di Indian corporation Hinduja Group, wey, despite a decline in fortune, dey recorded to be worth more dan £35bn.

Di number of billionaires go down to 156 dis year from 165 in 2024, representing di sharpest decline in di Sunday Times Rich List 37-year-history.

"Our billionaire count dey down and di combined wealth of those wey feature in our research dey fall," Robert Watts, compiler of di Rich List tell PA Media.

1. Gopi Hinduja and family (£35.3bn, dem go down from £37.2bn)

2. David and Simon Reuben and family (£26.87bn)

3. Sir Leonard Blavatnik (£25.73bn)

4. Sir James Dyson and family (£20.8bn)

5. Idan Ofer (£20.12bn)

Coming in second after di Hinduja family, at almost £27bn, na di Reuben brothers, wey make dia fortune through property and technology.

A close third na Sir Leonard Blavatnik, one Ukrainian born British-American businessman wey build up a net worth of almost £26bn.

Im wealth don drop by £6.473bn - more dan a quarter of im fortune - in di last year.

E now dey £17.046bn from £23.519bn, pushing am from fourth to seventh on di list.

Among oda notable figures to make di list be Formula One champion Sir Lewis Hamilton, David and Victoria Beckham, and Sir Elton John.

Dua Lipa, 29, na di youngest person to dey included on di sub-list of di richest Britons wey dey under 40. She dey at 34, with an estimated wealth of £115m.

Harry Styles, 31, dey di list at 22 with a fortune of £225m. Ed Sheeran, 34, dey number 13 with £370m.

Di King rise in wealth don also made am richer dan im late mother, Queen Elizabeth II.

Di new figures estimate Charles to dey worth £270m more dan im mother, with di majority of im fortune benefiting from di investment portfolio e inherit from her.

Tori be say di late Queen bin worth £370m in 2022 compared to Charles current fortune of £640m.

E no pay inheritance tax on di fortune she leave, due to one exemption. E for charge a standard of 40% on assets above di threshold.

E dey also make money from di private estate di Duchy of Lancaster. E cover more dan 18,000 hectares of land in areas such as Lancashire and Yorkshire, as well as property for central London.

Worth £654m, e dey generate about £20m a year in profits.

Mr Watts say researchers find say fewer "of di world super rich dey come live for UK."

E say: "We expect say di scrapping of non-dom status go vex wealthy people from overseas.

Di Labour government scrap di non-dom tax status for April, wey be where UK residents wey dia permanent home or domicile dey outside di UK for tax purposes.

Instead, dem dey face di new foreign income and gains regime now, wey provide tax relief on foreign income and gains for people for dia first four years of tax residence.

E only apply if dem never be tax resident for UK in any of di 10 consecutive years before dia arrival.

Last year, former Conservative chancellor Jeremy Hunt reveal plans to scrap di tax status before successor Rachel Reeves speed up di process.

Government expect say di package of measures go raise £12.7bn over di next five years. US President Donald Trump global tariffs, wey dey announced in April, don also get impact.

Di announcement see di stock markets drop immediately afterwards, with turbulence wey continue since and businesses wey dey face higher prices for US.