Nnamdi Kanu trial: Ipob leader announce creation of ESN, threaten Tinubu and ginger attack on Lagos - Court play video - BBC News Pidgin
Di trial of di leader of di Indigenous People of Biafra (Ipob) Nnamdi Kanu Kontinu on Wednesday for di Federal High Court, Abuja.
Kanu dey stand trial sake of allegation of terrorism wey di federal goment sama am.
As di matter start, di prosecution lawyer call dia second witness say im name na Mr BBB (no be real name).
Di witness na anoda DSS officer wey follow lead investigation into Kanu matter.
E tell di court how di former Attorney General of di Federation, Abubakar Malami, bin write letter to di Director General of di DSS on June 10, 2021, accusing Kanu of "conspiracy, murder, arson, and persistent killings of security operatives".
Di witness say na im take Nnamdi Kanu statement afta dem arrest am. E also follow for di officers wey interview am for di DSS headquarters for Abuja.
Di court admit di letter of di AGF as evidence and also one flash drive wey di prosecution counsel Adegboyega Awomolo bin present for court.
Di flash drive contain one video broadcast of Nnamdi Kanu on December 12, 2020.
For dat video, Kanu announce say IPOB don establish di Eastern Security Network (ESN) as e tok say "we don wait for di guvnors of di southeast to do wetin dia counterparts for di southwest bin don do, but since dem no wan do am, we dey take am into our hands to do am".
Di voice wey be allegedly Nnamdi Kanu own also tell one of im caller say make dem go prepare any weapon wey dem fit make and use am to kill police pipo anywia dem dey.
"And anyone una kill, make una cut off im head so dat dem go go to hell," di alleged Nnamdi Kanu voice tok.
For inside anoda recording, di alleged Nnamdi Kanu voice tok say im go pay anybodi wey fit bring down Wike N100 million.
For dat video, Kanu tok say Wike bin offer 50 million naira bounty on top of some IPOB members head, diafore im dey double di offer on too anyone wey fit kill Wike.
Witness BBB tok say di DSS bin play di video and audio recordings to Nnamdi Kanu and e bin gree say na im do dem.
Some of di tins Kanu tok for di video include:
For anoda video wey di goment play for court, one voice wey di DSS say na Nnamdi Kanu dey talk and tell pipo to "go and burn down Lagos", "set Murtala Mohammed Airport on fire", "burn down dat Tinubu hotel", "go into di bush, collect police dem gun and kill dem", etc.
Also, inside anoda video, dat voice wey be allegedly Nnamdi also tok say "evri Federal goment building for Lagos suppose dey on fire. Any goment vehicle burn am. Manfacture una own weapons, ambush dem".
Yet for anoda audio recording wey di Nigeria goment play for court, voice wey allegedly belong to Kanu dey tell pipo say "any police pipo wey una kill, go to dia station and set am on fire. Kill dem. Na janjaweeds dem be". E also say "Tinubu don enta trouble, e no go fit run. Anywia wey e run to for dis world we go find am". "If we no behave like mad pipo for dis zoological republic, dis revolution no go work".
"Start killing sojas now, set ambush for dem, dig hole for di roads so dat wen dia vehicles dey come e go somersault and dem go die".
Dis particular audio recording be like say na during di End SARS protest of October 2020 bicos di voice wey allegedly belong to Kanu dey ansa calls from pipo across Nigeria who dey give am update of wetin dey happen wia dem dey.
One of di callers wey say im dey for Ogbor Hill Aba tok say dem need guns, but di alleged Nnamdi Kanu voice tell am say make e join "di elite Biafra volunteer force" and e go understand how tins work.
For anoda voice recording, di voice wey allegedly belong to Nnamdi Kanu bin call for "a total sit-at-home for di whole of southeast tomorrow".
"Nobody dey allowed to come out no matter who you be. If you dare to open your shop tomorrow we go burn you inside dat shop,"di voice tok.
Also, di prosecution play anoda audio for court wia di alleged Nnamdi Kanu voice dey tell one man ova di phone say "we get some guns already for Edo state, take dose guns and kill some army officers, take dia guns and use am to attack di odas".
For anoda video, Nnamdi Kanu dey address some pipo for wetin look like conference and some of di comments e bin make be say dem go need guns and weapons for di Biafran struggle.
Di last video wey di prosecution team play for court na one wia Kanu dey tok say "di Fulani ethnic group wan take ova di entire Nigeria as dem take over Hausa territories. "Di only way we go stop dis na by revolution," e tok.
Lawyer to di Nigeria goment, adegboyega Awomolo also show di court one CD plate of Nnamdi Kanu interrogation for di DSS headquarters on 17 July 2021.
Di defense team say dem get objection for di CD plate to be accepted as evidence, but dem go give dia reasons later. Di court later accept di CD plate as evidence and mark am exhibit PWI and PWI-1 respectively.
Trial Judge, James Omotosho also accept in evidence di federal goment gazette of September 20, 2017 wey proscribed IPOB as a terrorist organization.
Omotosho adjourn di matter to Thursday May 8, 2025 for continuation of hearing.