India attack Pakistan for 'Operation Sindoor' - BBC News Pidgin
Wia dis foto come from, Reuters
India don launch revenge attack on Pakistan for wetin dia military call "Operation Sindoor"
Dem use missiles strike nine sites inside Pakistan and di Kashmir wey Pakistan dey run.
Di Indian strike dey happun as tension dey between di two neighbours after a deadly attack last month on tourists for di part of Kashmir wey India dey run.
For statement, di Indian goment say "nine sites we target".
"Our actions don dey focus, measured and non-escalatory in nature. No Pakistani military facilities dey targeted. India don show considerable restraint in selection of targets and method of execution."
Di statement add say dem order di attack afta last month deadly militant attack on tourists for India-administered Kashmir.
Indian Home Minister Amit Shah praise di kontri country armed forces in a post on X, saying e dey proud of dem.
Operation Sindoor - India name for dia strikes on Pakistan – na di kontri response to di "brutal killing of our innocent brodas for Pahalgam", e write.
"Di Modi goment don resolve to give a proper response to any attack on India and dia pipo. Bharat [India name in di Hindi language] remain firmly committed to remove terrorism from id roots," e add.
Pakistan claim say dem shot down five Indian aircraft.
"So far, I fit confam to you say five Indian aircraft - including three Rafale, one SU-30 and one MiG-29 - and one Heron drone don dey shot down," Pakistan military tok-tok pesin Lt-Gen Ahmed Sharif Chaudhary tok for video wey Reuters share.
India neva react to dos claims yet.
India strikes come in revenge to one militant attack wey kill at least 26 pipo, mostly tourists for di part of Kashmir wey India dey run.
Militants open fire on pipo wey dey visit Baisaran, one mountain-top meadow three miles (5 km) from Pahalgam.
Some survivors of di attack say di main targets of di gunmen na Hindu men.
Pakistan don deny say dia hand dey inside di attacks, but Indian police say two of di four militants wey dem suspect for di attack na Pakistani citizens. Security forces still dey try catch di suspects.
Both India and Pakistan don announce series of revenge measures against one anoda including to close borders and suspend a river water sharing agreement. Troops from both sides don also exchange small arms fire.
Indian prime minister Narendra Modi bin don earlier tok say di kontri go chase di di pipo wey carry out di attacks "to di ends of di Earth".
We dey update dis tori