Foto of Doyin Okupe

Wia dis foto come from, Doyin Okupe/Facebook

Nigerian politician, Doyin Okupe, don die at di age of 72.

Reports tok say e bin dey battle serious sickness wey dem suspect to be cancer.

Okupe, na medical doctor wey turn politician for Nigeria.

E work as tok-tok pesin for both former presidents Olusegun Obasanjo and Goodluck Jonathan.

For 2022, im lead di Obi presidential campaign under Labour Party.

Reactions don already dey come in as tori of e death spread.

Tok-tok pesin to former President Muhammadu Buhari on new media, Buhari Tolu Ogunlesi, on im X account tok say make im soul rest in peace.

"Dis October 1985 @nytimes piece profile 33-year-old Dr. Doyin Okupe and im Royal Cross Hospital for Obalende, Lagos, wey im co-founded wit Dr. Seyi Roberts and Dr. Ladi Okuboyejo. Make Okupe soul rest in peace. Amen," e tok.

Skip X post

Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

End of X post

Dem born Adedoyin Ajibike Okupe, wey pipo sabi as Doyin Okupe, on March 22, 1952, for Iperu-Remo, Ogun State, Nigeria.

Okupe do im primary school education for St. Jude School in Lagos and secondary school education for Igbobi College bifor im attend College of Medicine, University of Ibadan, wia im earn im first degree as medical doctor.

Di medical practitioner co-found Royal Cross Medical Centre for 1983 for Lagos, im also work as advocate for public health.

Okupe launch for politics under di National Republican Convention (NRC) as di national publicity secretary in 1999. E serve as tok-tok pesin for both former presidents under di People Democratic Party (PDP) Olusegun Obasanjo and Goodluck Jonathan.

For 2012, former President Goodluck appoint am as a Senior Special Assistant on Public Affairs.

E work as Director-General of di Labour Party (LP) presidential campaign for di 2023 election.

E later dump di party sake of wetin e describe as 'ideological differences.'

For December 2022, court find Okupe guilty of breaking money laundering laws afta im collect ova 200 million naira in cash from former National Security Adviser, Sambo Dasuki.

Di court sentence am to two years in prison wit di option to pay N500,000 fine for 26 counts (13 million naira), wey im later pay.