Gaza ceasefire deal: Wetin to expect as Israel agree to deal - BBC News Pidgin
Wia dis foto come from, Reuters
Gaza ceasefire go begin on Sunday at 08:30 local time, dat na 7:30am Nigeria time.
Na di mediators for Qatar, wey play very important part for di tok tok wey lead to dis ceasefire make dis announcement.
Di announcement dey come afta Israel don agree to one Gaza ceasefire deal wit Hamas wey include di realise of Israeli hostages in exchange for Palestinian prisoners.
Dis na major breakthrough since di attack begin 15 months ago, in response to Hamas attack on Israel on 7 October 2023.
Wetin dey di ceasefire deal and wetin we dey expect go happun next between Israel and Hamas?
Qatar wey bin follow organise di deal with United States and Egypt, bin give small details of am during im announcement.
Di deal dey in three stages.
First stage go happun inside di first six week, dat na 42 days wit "full and complete ceasefire".
US President Joe Biden bin confam say dem reach deal on Wednesday.
For dis stage, Sheikh Mohammed say Hamas go release 33 hostages – including civilian women, female soldiers, wounded civilians, children plus old pipo – in exchange for Palestinian prisoners wey dey Israel prisons.
But di Sheikh no tok exactly how many Palestinian prisoners dem go release.
Three hostages na im dem go release on di first day, one Palestinian official bin tell BBC before, and di remaining exchange go dey happun for regular intervals inside di six weeks.
Israel forces go also move go to di east, away from heavily populated areas of Gaza, displaced Palestinians go dey allowed to begin return to wia dia homes bin stand before.
Almost all of Gaza 2.3 million people leave dia homes as Israel bin continue to bomb di whole territory.
Hundreds of aid trucks go dey allowed to enta di territory every day, plus also rehabilitation of hospitals, clinics and bakeries, Sheikh Mohammed say.
Negotiation for di second stage go include di release of di remaining hostages, full withdrawal of Israeli troops and return to "sustainable calm." Dis one suppose begin on day number 16, one Palestin official tok.
Biden say di ceasefire go continue "as long as di negotiations continue".
Stage two go be "permanent end to di war", according to Biden.
Di remaining hostages wey still dey alive, including men, go dey released in return for more Palestinian prisoners.
Inside di 1,000 Palestinian prisoners wey Israel suppose agree to all togeda, about 190 dey serve sentences of 15 years or more.
One Israeli official bin tell BBC before say di ones wey dem convict of murder would no go follow for di released ones.
Wia dis foto come from, Reuters
Di third and final stage na di return of di deadi bodi of di remaining hostages and di reconstruction of Gaza – sometin wey go take years.
Biden say dis deal go "halt di fighting for Gaza, increase much needed-humanitarian assistance to Palestinian civilians, and reunite hostages wit dia families afta more dan 15 months in captivity".
But one question wey never get ansa including which hostages dey alive or dead, or weda Hamas know about all di ones wey nobody still fit account for.
Hamas bin seize 251 hostages wen e attack Israel for October 2023. E still dey hold 94 captive, although Israel believe say na only 60 still dey alive.
Israeli gonment tok tok pesin David Mencer don fist tok say no be everybody inside di 33 hostages still dey alive.
Israel dey expected to release about 1,000 Palestinian prisoners, some don dey prison for years, in return for di hostages.
Di journey to get to dis point no be small tin, as e bin take months of careful indirect negotiations - becos Israel and Hamas completely no trust each oda.
Hamas want complete end to di war before e go release di hostages, sometin wey dey unacceptable to Israel.
Di ceasefire deal go pause di war as dem dey carry out di agreements of di deal.
However, e never clear weda dis one mean say di war don end for good.
Israel main objective or purpose for di war bin be to destroy everytin Hamas both im military and governing capabilities.
But e no achieve im objective becos, although Israel seriously damage am, Hamas still dey operate and regroup.
For im part, Hamas don demand di release of some prisoners wey Israel say im no go free. Di believe be say dis fit include di pipo wey get hand for for di 7 October attacks.
E no dey clear yet weda Israel go agree to pull out of di buffer zone between am and Gaza by end of one date, or weda e go remain dia till whenever.
For dis reason, any ceasefire for dis warfi dey very fragile.
Ceasefires between Israel and Hamas wey bin stop wars between di two before, bin scata sake of clashes.
Di timetable and complicated nature of dis ceasefire mean say even one tiny kpakaram fit turn into major threat.
Hundreds of Hamas gunmen launch di kain attack wey bin never happun before on southern Israel, as dem burst through di border fence and target communities, police stations and army bases.
About 1,200 pipo die and more dan 250 hostages n aim dem carry go back to Gaza. Hamas also fire thousands of rockets enta Israel.
Israel respond wit massive military campaign, first by air and den ground invasion.
Since dat time, Israel don attack and destroy everyway for Gaza by land, sea and air, while Hamas continue dey attack Israel wit rockets.
Israel offensive don scata everytin for Gaza and lead to serious food shortages, wit no access for aids to reach pipo wey need dem.
More dan 46,700 pipo - majority of dem women and children – don die for Israel attacks, according to Hamas health ministry.