Wetin dey agenda as Europe leaders dey gada for paris today - BBC News Pidgin
Wia dis foto come from, Getty Images
Europe leaders go gather for di French capital today to discuss dia defence policy, Ukraine war - and how ceasefire dia fit look like.
We expect UK, France, Germany, Italy, Poland, Spain and Denmark, plus one representative from EU Council and Nato, to dey for di Paris talks.
Dem rush organise dis meeting as US officials prepare to meet one Russian delegation for Saudi Arabia on Tuesday.
French foreign minister say today summit no be something to "over-dramatise" - but e dey come at a crucial moment for di Ukraine war, as US President Donald Trump dey push Russia and Ukraine to start peace talks.
Military spending, too, go likely dey di agenda of discussion for Paris. Donald Trump want European countries to spend 5% of GDP spent on defence - di current Nato target na 2%.
On Monday morning, UK prime minister Sir Keir Starmer say UK dey "ready and dey willing to put troops for ground".
Even for Germany, ahead of one heated election, di foreign policy tok-tok pesin of di CDU party, wey dey expected to win most of di seats say, Europe largest kontri go also commit troops within international framework.
Trump administration no dey 100% sure of wetin dem wan do about Ukraine. Some mixed messages bin fly ova di weekend.
Dis one allow Europe tiny window of opportunity to try persuade di American president say dem be partner im no fit throw one side. Dem dey hope to do am via dis Paris meeting.
Europe leaders insist Kyiv must dey directly involved in ceasefire toks too. For long, dem don maintain di opinion say " decisions about Ukraine no fit dey, without Ukraine".
No be all European countries go dey for Monday summit. Na only those wit military might go show: UK, France, Germany, Italy, Poland, Spain and Denmark – wey dey expected to represent di Baltic and Nordic nations, plus di EU Council president and di secretary general of di defence alliance, Nato.
Reports say oda countries go later hold follow-up meetings.
Even for di small Paris gathering, e go dey hard, if not impossible, to agree on concrete defence spending increases.
Poland dey plan to spend 4.47% of dia GDP on defence for 2025. UK dey struggle and dem neva reach, 2.5% of dia GDP.
But leaders fit pledge to coordinate beta, spend more inside Nato and shoulder most of Ukraine post-war reconstruction.
Di EU dey expected to boost dia defence effort too.
Large part of di Paris meeting go also focus on di question of sending troops to Ukraine afta a ceasefire.
Di idea dem wan discuss no be about peacekeeping troops but instead, "reassurance force", wey dem go station behind, rather dan on any eventual ceasefire line.
Di purpose of di European troop presence go be in three-fold. Firstly, na to send message to Ukrainians: say dem no dey alone. Another message na to di US, to show say Europe dey "do dia bit" for defence of dia own continent, and di last message na to Moscow, to warn say if dem break di terms of an eventual ceasefire, no be only Kyiv dem go dey deal wit.