Which kontri dey for and against Ukraine afta di gbas-gbos for di White House - BBC News Pidgin
Wia dis foto come from, EPA
European leaders don rally behind Volodymyr Zelensky afta Donald Trump hot clash wit di Ukrainian president for di White House.
Di leaders of Germany, France, Spain, Poland and di Netherlands dey among those wey post social media messages to support Ukraine - Zelensky also respond directly to each one to thank dem for dia support.
Dis dey come afta one extraordinary meeting for di Oval Office on Friday, 28 February, as US President Trump clash wit Zelensky and tell am to make deal wit Russia "or dem go comot body".
At one point, Trump tell Zelensky say e no dey thankful enough for US military and political support during Ukraine fight against Russia invasion, and say e dey "gamble wit World War Three".
Plenty of supportive messages don come from European leaders wey dem post afta di gbasgbos – plus posts from di prime ministers of Canada, Australia and New Zealand - Zelensky reply to each one: "Thank you for your support."
Also plenty Ukrainians don back dia president afta di White House meeting
Di initial reaction na dat of shock," opposition MP Inna Sovsun tok.
"E bin dey difficult to watch leader of di free world attack a president wey be victim of Russian aggression," she add. "E dey painful."
However, Russia don call di visit complete failure.
Di Kremlin foreign ministry spokeswoman call Volodymyr Zelensky visit to Washington on Friday a "complete diplomatic failure of Kyiv".
Maria Zakharova bin go on to add say Ukrainian president dey "obsessed" wit prolonging di war and add say Moscow goals remain "demilitarisation" of Ukraine and annexation of all territories wey Russia currently dey occupy.
"Wit im outrageously rude behaviour during im stay for Washington, Zelensky confam say e be di most dangerous threat to di world community as an irresponsible instigator of a major war," Zakharova claim.
Wia dis foto come from, Reuters
French President Emmanuel Macron post: "Aggressor dey: Russia. Victim dey: Ukraine. We dey right to help Ukraine and sanction Russia three years ago - and to keep doing so."
Dutch Prime Minister Dick Schoof tok say di Netherlands support Ukraine "now more dan ever", and add say: "We want lasting peace and an end to di war of aggression wey Russia start. For Ukraine and dia pipo, and for Europe."
Germany outgoing Chancellor Olaf Scholz write say "no one want peace more dan di citizens of Ukraine", wit im replacement-in-waiting Friedrich Merz wey add say "we stand wit Ukraine" and "we must never confuse aggressor and victim for dis terrible war".
Spanish Prime Minister Pedro Sanchez say: "Ukraine, Spain stand wit you," while im Polish counterpart Donald Tusk write: "Dear [Zelensky], dear Ukrainian friends, you no dey alone."
European Commission President Ursula von der Leyen tell Zelensky: "Your dignity honour di bravery of di Ukrainian pipo."
Canadian Prime Minister Justin Trudeau tok say Canada "go continue to stand wit Ukraine and Ukrainians to achieve a just and lasting peace".
Australian Prime Minister Anthony Albanese post say im kontri don "proudly support di brave pipo of Ukraine for dia struggle to defend dia sovereignty against di brutality of Russian aggression and in support of international law".
Supportive messages for Ukraine also come from political leaders for Austria, Belgium, Croatia, Denmark, Estonia, Finland, Ireland, Latvia, Lithuania, Luxembourg, Moldova, Romania, Sweden and Slovenia.
However, Hungarian Prime Minister Viktor Orban voice im support for Trump, e write: "Strong men make peace, weak men make war. Today President @realDonaldTrump stand bravely for peace. Even e dey difficult for many to digest. Thank you, Mr President!"
Wia dis foto come from, AFP
Zelensky comot di White House early afta im row wit Trump - but e later thank di US president on social media for im support, e say: "Ukraine need just and lasting peace, and we dey work exactly for dat."
E write on im messenger app Telegram on Saturday, say e dey "very important for us say Ukraine dey heard and make nobody forget about di kontri, neither during di war nor afta".
"E dey important for di pipo of Ukraine to know say dem no dey alone, plus say dia interests dey represented for evri kontri, and for evri corner of di world," e add.
For one interview wit Fox News afta im White House visit, Zelensky say im issue wit Trump no dey " good for both sides" but e tink say dem go manage dia relationship.
Di two of dem bin interrupt each oda repeatedly for front of di media during wetin suppose be introduction wey go lead di two leaders to sign one agreement wey go give America access to Ukraine deposits of rare earth minerals.
"Dem [Donald Trump and JD Vance] bin dey so rude," 30-year-old Andriy. "Dem no respect di pipo of Ukraine."
"E be like say Washington dey support Russia!" Dmytro, 26 observe.
You wonder wetin di last 24 hours don do to President Zelensky popularity.
"Wen di situation become worse, we do anoda rallying around di flag," Volodymyr Paniotto, director of Kyiv International Institute of Sociology wey dey carry out some of di polling explain.
World leaders' popularity dey often go down ova time, and Mr Paniotto say dat no affect President Zelensky.
Im ratings bin shake during Ukraine failed counteroffensive of 2023, and wen e sack one popular commander in chief of im armed forces, Valeriy Zaluzhnyi.
But Donald Trump new, transactional, often-hostile approach to Ukraine don force di kontri to unite and brace for further uncertainty.
Wia dis foto come from, Kharkiv region state emergency service DSNS
Meanwhile, hours afta Zelensky comot di White House, Ukraine say 12 pipo bin dey injured afta one overnight drone attack from Russia for di north-eastern city of Kharkiv.
Di state emergency service DSNS say 64 pipo most of dem patients bin dey comot from one three storey medical facility wey catch fire as one of di drones hit am.
Residential buildings, a shopping centre and oda civil infrastructure facilities bin dey damaged too according to DSNS.
For Russia, di kontri defence ministry report say 48 Ukrainian drones bin dey "intercepted and destroyed" overnight for eight regions. Dis include Crimean peninsula wey dem collect from Ukraine hand for 2014.