Wetin we call dis Video, BBC kwesion Trump sake of Ukraine no dey invited to US-Russia toks

Donald Trump don respond to Ukraine afta President, Volodymyr Zelensky, tok say na "surprise" say im kontri no dey invited to di tok-tok for Saudi Arabia to end di war wit Russia.

Say e dey "disappointed" by Ukraine reaction, e be like e dey blame Ukraine say dem start di war, say di kontri "for don make a deal" earlier.

One full-scale Russian invasion bin spark di war in Ukraine almost three years ago.

Earlier on Tuesday, Russian Foreign Minister Sergei Lavrov meet US Secretary of State Marco Rubio for Riyadh for di first high-level, face-to-face tok-tok between di two kontris since di invasion, and agree to appoint teams to begin negotiate di end of di war.

Lavrov say im kontri no go accept peacekeeping forces from Nato kontries for Ukraine under any peace deal, one proposal dem raise for di meeting of European members of Nato for Paris on Monday.

European Nato states, wey remain committed to support Ukraine against Russia, no dey smart for how dem dey sidelined by Trump unilateral peace initiative, wey reverse di pro-Ukraine policy of im predecessor as president, Joe Biden.

Following wetin e call "di infamous meeting" - wey dem no invite Ukraine to - Zelensky bin accuse di Russian delegation for Riyadh of lie, add say Russia no fit dey trusted and "must dey pressured for peace".

For toks to tori pipo for im Mar-a-Lago residence, BBC News bin ask Trump wetin im message be to Ukrainians wey fit feel betrayed.

"I hear say dem dey vex about say dem no get seat, well, dem bin don get seat for three years and one long time bifor dat. Dis fit don dey settled very easily," e tok.

"You for no ever start am. You fit don make a deal," e later add.

"I for don make a deal for Ukraine," e tok. "Dat fit don give dem almost all of di land, evri tin, almost all of di land - and no pipo fit don kill, and no city for don dey demolished."

Afta di meeting for Riyadh, Trump say e dey "much more confident".

"Dem dey very good," e tok. "Russia wan do sometin. Dem wan stop di savage barbarianism."

"I tink say I get di power to end dis war," e bin add.

Trump also criticise di length of time since election don hold for Ukraine, wen dem ask am if di US go support Russian demands for one to hold.

"Dey want seat for di table, but... di people of Ukraine no go have a say? E don tey since we don have one election," di president bin answer.

E also claim say Zelensky - wey bin win one five-year term for 2019 - dey "down for 4% approval rating".

Zelensky don remain for office while di kontri dey under martial law following di start of di conflict. One opinion poll for December bin suggest say 52% of Ukrainians survey say dey "trust" Zelensky.

Meanwhile, wen dem ask about di prospect of European kontris to send troops to Ukraine, Trump say: "If dem wan do dat, dat's great, I dey all for am."

Afta Monday meeting for Paris, British Prime Minister say make dem no attack im neighbour again.

Sir Keir say "US security guarantee na di only way to effectively stop Russia", and vow to discuss di "key elements" of peace deal wit Trump for Washington next week.

Russian Foreign Minister Sergey Lavrov (C) and Russian President Vladimir Putin Foreign Policy Advisor Yuri Ushakov (2nd R) chat wit Saudi Arabian officials, following meeting between Russia and di United States for Ukraine, in Riyadh, Saudi Arabia,

Wia dis foto come from, RUSSIAN FOREIGN MINISTRY / HANDOUT

Wetin we call dis foto, Sergei Lavrov and Marco Rubio hold toks for Saudi Arabia

Also for di tok-tok for Riyadh na US Middle East envoy Steve Witkoff and US National Security Advisor Mike Waltz, as well as Russian presidential aide Yury Ushakov and di head of Russia sovereign wealth fund, Kirill Dmitriev.

Stress say Moscow no go gree to peacekeeping forces from Nato kontries for Ukraine under any peace deal, Lavrov tok: "Any appearance by armed forces under some oda flag no dey change anytin. Of course e dey completely unacceptable."

E say di US and Russia go appoint ambassadors to each oda kontris as soon as possible and create conditions to "restore co-operation in full".

"Na very useful conversation. We bin listen to each oda, and we hear each oda," e tok.

E repeat say Russia previous position say any expansion of di Nato defence alliance - and Ukraine to join am - go be "direct threat" to Russia.

Rubio for im part say e dey "convinced" Russia dey "will to begin to engage for one serious process" to end di conflict.

"All sides need to concede somtin. We no go predetermine wetin dem be."

"Today na di first step of one long and difficult journey, but important one", e add.

Rubio say di European Union go "need to be at di table at some point sake of say dem get sanctions wey don dey imposed".

On absence of Ukraine for di meeting, e insist say "no-one dey sidelined".

"Everyone wey get hand for di conflict need to dey OK wit am, e need to dey acceptable to dem," e add.

Di tok-tok for Paris, wey dem rush arrange for response to di obvious dislike between Russia and di US under Trump, no gree any unified position.

Germany Chancellor Olaf Scholz say to dey discuss to send troops to Ukraine for present dey "completely premature".

Poland Prime Minister Donald Tusk also tok say e no get mind to send troops while Italy Giorgia Meloni - di only European leader to attend Trump inauguration - express doubts.

She bin tell di meeting for Paris say to deploy European troops go be "di most complex and di least effective" way to secure peace for Ukraine.

Volodymr Zelensky look downcast for immeeting for Turkey

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Volodymr Zelensky look downcast for im meeting for Turkey

Ukraine leader look tired and dey vex wen e give im reaction to di Riyadh meeting during one news conference forTurkey.

"We want everytin to dey fair and so dat nobody go decide anytin behind our back," Zelensky tok.

"You no fit make decisions without Ukraine on how to end di war for Ukraine."

E go dey alarmed by all di smiles on both American and Russian faces for Riyadh, but e go know say e fit do little to change whatever dey agree on over im head.

Di Ukrainian president go also know say im kontri chances to resist - let alone defeat - Russian troops without American help dey very slim.

Map show areas of Russian military control for Ukraine for red highlighted.

Following di overthrow of Ukraine pro-Russian president for 2014, Moscow bin annex di Black Sea peninsula of Crimea and back pro-Russian separatists for bloody fight for eastern Ukraine.

Di conflict burst into all-out war wen Russia invade Ukraine on 24 February 2022.

Dem stop Moscow attempts to take control of di capital Kyiv, but Russian forces don take around one-fifth of Ukraine territory for di east and south, and don carry out air strikes across di kontri.

Ukraine don retaliate wit artillery and drone strikes, as well as ground offensive against Russia western Kursk region.

Accurate casualty count dey hard to come by but e dey estimated say hundreds of thousands of pipo, most of dem sojas, don dey killed or wunjure, and millions of Ukrainian civilians don run comot as refugees.

Additional reporting by George Wright, Gabriela Pomeroy and Vitaliy Shevchenko