Navigation

© Zeal News Africa

Wetin dey inside Justin Bieber new album, Swag

Published 3 days ago4 minute read

Justin Bieber don shock fans wit di release if im new album wey im call Swag

Justin Bieber don shock fans wit di release if im new album wey im call Swag.

Di album na 20 songs wey get track names like Dadz Live, Devotion and Therapy Session.

Dis dey come afta fans bin dey fear about di musician mental health online afta e para for paparazzi.

Dem film one of di video wey go viral on Father's Day, wen e jam one photographer come dey hala am say, "I be papa. I be husband. You no get am. E no dey click for you. I dey stand on business."

Di video bin go viral sotay dem carry am remix am for online, even Bieber join di trend as e post di meme for im own social media account.

And guess wetin hapun? Not only say im add di sound as part of di promotion for di new album, e dey inside one of di songs wey dem call Butterfly.

<2>Wetin dey inside di album?

Di album no even reach one hour in length but di ogbonge star wey blow as teenager, collabo wit plenti ogbonge rappers for Swag like Sexxy Red, Cash Cobain and Gunna.

Oda artistes wey feature for di album na American comedian and actor, Druski; Austrailian singer, Eddie Benjamine and gospel artiste, Marvin Winans

Di title be like say e dey come from Bieber 2012 hit wey im call Boyfriend, wey im sing inside di line, "swag, swag, swag, on you".

Di pictures wey di Canadian post to promote di album show im wife Hailey Bieber and dia male pikin - wey dem sometimes hold ova im head.

Infact, e even torchlight im marriage mata for di second song for di album, wey im call Daisies wia e use lyrics like, "falling petals do you love me or not" and "you said forever babe, did you mean it or not?"

Also, as don be practice for am for im last two albums, e torchlight im Christian faith for inside di album wit songs like Devotion, Soulful and Forgiveness.

Fans don dey torchlight dis album as e be like say e dey come back into wetin dem call im "light skinned Bieber era".

Dis na based on the name of di song and how im barb im hair for di picture for di album and also di fact say im social media name now be LIl Bieber, in stead of di Justin Bieber wey im bin dey bifor.

For di past few months, di singer don dey post plenti ties online dey hala on top how paparazzi dey affect im personal life.

Pipo don also torchlight Justin Bieber marriage afta one controversial social media post.

Di post na wen di singer bin dey celebrate im wife cover feature for Vogue magazine, but use argument wey dem bin get take do am.

Plenti artistes and fans don hail di release of new music ontop say e don reach four years since di last time wey im drop album wey im call Justice.

American rapper Big Sean bin dey among di famous names wey welcome di album release, as im comment for di announcement for di singer Instagram say "Yes!!!!"

Ova di years, no be only Justin Bieber mental health don make pipo torchlight im life, dis four hiatus wey im just break dey come afta a physical condition wey make am pause im tour for Justice.

For June 2022, Justin Bieber postpone im Justice World tour bicos of wetin dem dey call Ramsey Hunt Syndrome wey im tok say give am facial paralysis.

Pipo don dey torchlight dis album on top say di Justin Bieber from Justice no be di same Justin Bieber of Swag as e don become papa during di break and comot hand from im fashion line wey im bin dey run for long time wey im bin call Drew.

Origin:
publisher logo
GhanaWeb
Loading...
Loading...
Loading...

You may also like...