united europa win

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Jose Mourinho bin dey in charge when Manchester United win di Europa League for 2017

"Dis na crossroads moment"

Dat na verdict of former Manchester United first team coach Rene Meulensteen about di club im Europa league final wit Tottenham on Wednesday.

Like many United fans, di Dutchman now bin dey accept dia disappointing season for di England side, wey im dey fear wetin go happun if United no win di Europa league for Bilbao.

"To win di Europa league go be small success for dis disaster season," Rene Meulensteen tok BBC sport, as United dey 16th for di Premier league - dia lowest position for di league for ova 50 years.

"If di team no win di trophy, why we go expect sometin different next season? Di trophy go create space for di team to sign players.

"If dem no win, we no go play for Europe wey I bin dey worry wetin di future go look like."

Wit wetin don happun dis season and di chance to play for di Champions league next season if united win di Europa, na easy tin to see why dis match na 'do-or-die' moment for Manchester United.

But dis Europa League final dey significant?

"Financially, dis na di most important match for di history of di club," football finance sabi pesin Kieran Maguire don tok.

"To dey play for di champions league na good tin, sake of e fit to generate ova £100m from tickets, TV broadcast moni and di moni from sponsorship bonuses."

Wit four home games for di competition if di team don reach far, dem go get anoda £30m-£40m.

Even tho di benefits for United to enta di Champions league plenti, na so e dey for Spurs, but United need am more.

Spurs lose £26m last year, wey United also bin lose £113m ova di same period, wey bin mean say, dia total loss for di last three years, na £300m.

Last year, United make £651m, di fourth highest by any club for world football, even tho dem no dey perform well for some time now.

But afta di takeova of di club by majority owners di Glazer family for di year 2005, di club also bin get £1bn debt, wia dem dey spend millions of pounds evri year to clear.

United don admit say dem dey at risk of failing to follow di premier league profit rules.

team photo

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, United dey finish below di top 10 dis season for di premier league, but if dem win di europa league, dem go play for di champions league next season

Fans don dey happy say at least di club dey target players like Liam Delap, Antoine Semenyo and Matheus Cunha.

But if United fail to sell players wey dey collect plenti salary like Marcus Rashford, Jadon Sancho and Antony, weda di new players go come di club or not, go depend on wetin go happun for Bilbao.

Players to like to come di club if dem fit play for Europe.

"United still get one of di highest wage bill for di premier league. Dem get squad wey cost more dan £1bn, wia many of di deals dey on credit – na so dem get debt of ova £300m to pay,' Maguire tok.

"So United need di moni from di Champions league to meet dia financial obligation, dis na bifor dem go start to buy players wia di manager dey want."

Former United defender Rio Ferdinand wia tok PA say to win di Europa league go begin "new era" for di club.

"Wit Manchester United, dem dey need di moni to buy players for dis manager, na crucial time for di club."

For di owners of di club, to win a trophy go help to pay for di £14.5m wia dem bin spend to sack di former manager Erik Ten Hag, togeda wit di former sporting director Dan Ashworth wia dem hire and fire.

As pressure bin dey mount ova di club decisions, di bosses neva explain how dem go find di moni to build di new stadium wia dem wan build – wey go cost at least £2bn.

At di time wen Ratcliffe don dey reduce investment for oda sports, to win di European trophy since im take ova for Old Trafford, go boost di club im profile.

To win for Bilbao, go cost Maguire dey estimate say to qualify for di champions league go mean say United go pay 25% extra as salaries.

But im believe say di champions league go "change tins".

United manager Ruben Amorim don tok say to dey play for Champions league dey more important dan to win di Europa league.

"Di best way to help di club reach di top in a few years, na di Champions league, no be di cup" im tok.

Dem bin ask di manager say if United no play for Europe next season, wetin go happun.

Na so Ruben Amorim tok say "to lose di final against Spurs go be really bad tin for di club, di fans and di media go give us plenti pressure."

For Spurs, dis na dia chance to win dia first trophy since 2008, wia dem also wan get sometin from dis premier league season wey neva go well, just like Manchester United.

Dis na domestic failure for teams wia bin dey describe diaserf as "Big Six" clubs.

Fans don protest di club dis season ova wetin dem describe as lack of investment buy di owners of di club and how dia chairman oga Daniel Levy bin dey handle tins.

"To qualify for di champions league go put Spurs for good place," Maguire don tok.

"Na dem be di team wia dia managers don dey run dia business well well for di premier league. Dem gat di most profits for history – dem fit to raise moni from non-football activities than any oda club."

For United, second season without Champions league go mean say di club go pay dia kit provider Adidas £10m penalty under di terms of dia deal.

One former senior pesin for di club don tok say di club fit lose some of dia sponsorship if dem no qualify to play for Europe, for di second time in 35 years.

"If di team no play for Europe, e go create [plenti wahala," dem tok BBC Sport.

"Dis no be good tin, wey pipo also bin dey ask if United still na big team."

spurs

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Spurs manager Ange im job no dey guaranteed even if im win di Europa league

If dem win, e go keep di club running, di cash go be wetin go allow dem to keep di business.

If dis no happun, dem gat to begin to tink about selling homegrown players like Alejandro Garnacho and Kobbie Mainoo to give dem di moni dem dey want."

Some United fans go travel go Bilbao to watch di match – dem go hope say e go bring memories of di 1991 Cup winners cup wia dem win – wey begin di Alex Ferguson glory years.

Odas go look at 2017, when Jose Mourinho bin win di Europa League final, to qualify for Champions league even tho dem finish sixth for di league.

But to look how bad United bin dey dis season, to win dis Europa league trophy go be wild.

Both coaches, Ruben Amorim and Spurs boss Ange Postecoglou don try to reduce di pressure on dia team ahead of di game as dem tok say to win di trophy be good tin but e no be wetin go change anytin.

Spurs dey on course for dia worst-ever premier league season, even if dem win di trophy, dat no go ey enough for Ange Postecoglou to keep im job, but Ruben Amorim don secure im own job next season even if United lose di final.

Di neutral football fans go enjoy di game, but United and Spurs fans go hope say dis match go change dia season.

For Bilbao, di city wia pipo sabi as one for regeneration, na chance to start di revival.

To lose go mean say di recovery plan go dey long.