Brooklyn Bridge Collision: Video show how one Mexican Navy ship hit di bridge - BBC News Pidgin
Two pipo don die and at least 19 odas injure afta one tall Mexican Navy training sailing ship crash inside New York City Brooklyn Bridge.
Police tok say Cuauhtémoc, wey get 277 pipo on board, bin lost power on Saturday, 17 May as di captain bin dey manoeuvre di vessel, and dey force am to move go di bridge abutment on di Brooklyn side.
Footage show as di ship towering masts clip di bridge as e pass under di structure. E show as crew members wey stand on di masts stagger and fall to di deck, authorities tok.
Brooklyn resident Nick Corso, wey witness di accident, tok say pipo for di area begin panic afta di incident. "Plenty pipo dey scream, some sailors bin hang from di masts," e tell AFP.
Wia dis foto come from, Anadolu via Getty Images
New York City Mayor Eric Adams bin confam on X say two pipo die and two of di 19 pipo wey injure dey for critical condition.
Brooklyn Bridge no suffer any serious damage and dem don reopen am afta preliminary inspection.
Police say dem believe say "mechanical issues" and power cut na im cause di collision.
Di New York Coast Guard tok say di Cuauhtémoc lost all three masts. All personnel on di ship bin dey accounted for and no-one fall inside water.
Crowds run comot from di water as di ship hit di bridge.
Anoda witness, Kelvin Flores, tell BBC say im bin dey work wen e see di crash.
E come out into di street to find a lot of "commotion and plenty chaos" wit fire engines and police dey try reach di scene but di roads block sake of traffic.
"I just dey see say di real damage dey very serious," e tok. "Pipo dey carry stretchers... dem dey try remove pipo wey injure."
Mexico President Claudia Sheinbaum tok say she dey deeply sad wit di loss of two crew members for di accident.
Dem tow di Cuauhtémoc from di scene afta di crash.
Di vessel, wey measure 297 feet long (91m) and 40 feet (12m) wide, according to di Mexican navy, sail for di first time in 1982.
Each year, e dey set sail at di end of classes for di naval military school to finish cadets training.
Dis year, e comot di Mexican port of Acapulco on 6 April, navy tok. Im final destination suppose be Iceland.
Police tok say di Cuauhtémoc mast height na 48.2m (158ft). Di New York transport department website say di bridge get 135ft clearance for dia centre.