Log In

Mexican beauty influencer bin dey do TikTok livestream wen pesin shoot her dead

Published 11 hours ago2 minute read

Valeria Marquez bin get a total of 200,000 followers across TikTok and Instagram

Dem don shoot one 23-year-old Mexican social media influencer dead while she bin dey live stream on TikTok, di state prosecutor office tok.

Valeria Marquez die wen one man enter her beauty salon for di city of Guadalajara "and use gun fire her", according to di Jalisco state prosecutor office.

Di motive for di fatal attack never dey identified but authorities dey investigate di case as a femicide - wen women and girls dey killed because of dia gender, di state prosecutor tok.

Gender-based violence dey highly common for Mexico wia di UN report say 10 women or girls dey, dey murdered every day by partners or family members.

Moments before her death, Ms Marquez bin sidon wit table, she hold one toy animal for her beauty salon for di suburb of Zapopan, she bin dey do livestream.

Seconds later, di man shoot her dead, wit di footage only ending wen anoda person pick up her phone to stop di recording.

Local media report say di man wey kill bin pretend say e dey bring her gift.

Police arrive for di scene around 18:30 local time (12:30 GMT) and confam Ms Marquez death, according to di state prosecutor.

Di prosecutor office no name any suspect.

Fans of Ms Marquez, wey her social media following reach nearly 200,000 across TikTok and Instagram, don react with horror to her death.

Mayor of Zapopan Juan José Frangie say im office no get any record of Ms Marquez requesting help from di authorities due to threats against her, adding say, "a femicide na di worst thing", according to news agency AFP.

Di state prosecutor say forensic experts dey investigate di shooting.

Origin:
publisher logo
GhanaWeb
Loading...
Loading...
Loading...

You may also like...