Log In

Court jail pastor 53 years in prison say e rape im 14 years old daughter

Published 8 hours ago3 minute read

Justice Olubunmi Abike-Fadipe of di Lagos State Sexual Offenses Court Ikeja don sentence one 45-years-old man to 53 years in prison say e rape im 14-years-old biological daughter.

Di court find Pastor Ndukwe Ogbu guilty of di three count charges wey Lagos state goment sama di defendant. Di charges include sexual assault, sexual assault by penetration and defilement.

Wen e dey read di judgement on Monday, di judge say di convict no dey remorseful say e rape im own daughter and no even apologize but e dey ask court to temper justice with mercy, say e get oda children to take care of for house.

Di court find am guilty on count one and sentence am to three years in prison. On count two court sentence am to 25 years and anoda 25 years for count three, wey make am 53 years in prison.

Di judge rely on di testimony from di victim, dat of di doctor wey examine her and testimony of di social worker wey report di case to sentence di man.

‘My father dey enta my room naked and force imsef on me' - Victim

During di proceedings in court di victim tell court how her papa dey enter her room naked, remove her clothes and force imsef on her.

She say di whole matter start from wen she dey 14-years-old.

She say di papa threaten am say make e no tell anybody.

Di victim confide in her school teacher wey notify di social worker and di social worker report di matter to di police.

She tell court say her papa do sexual intercourse wit her on plenty occasions.

For im defense, Mr Ogbu tell court say na true say im and di daughter dey stay for two bedroom apartment, but im no dey house wen di matter happun, say im daughter dey mentally unstable and forgetful.

E confirm say true true im wife die wen im kids dey small, say di oda children dey stay for village wit dia maternal grandma.

Na for February 2021 dem arraign di convict for court while di trial start for October 2021.

Di judge say di prison terms go run concurrently starting from 2019 wen dem first arrest di man.

Cases of child sexual abuse don dey high in recent times. Most of di reported cases na between di pikin and dia papa.

For April, Justice Rahman Oshodi jail two men ten years in prison say dem sexually abuse 16 years old boy for Lagos. Similar case happun for December 2024 wen justice Abiola Soladoye sentence one Mr Kayode Abegunde to life imprisonment say e sleep wit im daughter wey be minor multiple times.

Origin:
publisher logo
GhanaWeb
Loading...
Loading...
Loading...

You may also like...