Log In

Why police arrest and put Chris Brown for custody

Published 12 hours ago2 minute read

Dem don put R&B singer Chris Brown for custody

Dem don put R&B singer Chris Brown for custody afta e appear for court charged on top accuse say e use bottle attack one pesin for one London nightclub.

Police arrest di American singer for Manchester Lowry Hotel on Thursday, 15 May and dem later charge am ova one alleged assault, dem say happun for di Tape club for London Mayfair for 2023.

Dem allege say Chris Bron wey be 36-year-old use bottle cause serious bodily harm to music producer Abe Diaw.

Di singer bin dey Manchester ahead of one tour wey e plan to do for UK for June and July, for di city Co-Op Live Arena for Manchester and di Principality Stadium for Cardiff.

During di hearing, Brown, wey wear black tracksuit bottoms and one plain t-shirt, bin confam say im full name na Christopher Maurice Brown and im date of birth.

Wen court ask am to confam im address, e say na The Lowry Hotel.

District Judge Joanne Hirst tell Brown say dem go move di case go Southwark Crown Court for London, and di next hearing go be 13 June.

She say di nature of di offence of grievous bodily harm dey too serious and e pass wetin magistrates court fit deal wit.

Fans bin gada outside Manchester Magistrates' Court ahead of the hearing.

One fan, wey dey live for Manchester, tell BBC say she bin cancel her plans so she go fit spend di day outside court.

Candy, 35,say she don dey follow di star since she be 14 and wen she hear di news of im arrest she bin no fit sleep.

"I just dey here to support am," she tok.

"I love im music, im voice. Even my children don become im fans now."

Origin:
publisher logo
GhanaWeb

Recommended Articles

Loading...

You may also like...