Wetin PDP governors position mean for di party ahead of 2027?
Govnors in di Peoples Democratic Party (PDP)
Govnors in di Peoples Democratic Party (PDP) wey be di biggest opposition political party for Nigeria don rule out any option of join bodi wit oda opposition parties in oda to beat di ruling All progressives Congress (APC) by 2027.
Dis na one of di decisions wey di govnors reach for dia meeting for Ibadan, Oyo State on Monday and e dey come for a time wen big members of di party, including former Vice President Atiku Abubakar, dey make moves to join body wit oda political parties.
"Di PDP no go join any coalition or merger. However, di PDP as a major opposition party go welcome any party, persons or groups wey dey willing to join dem to wrestle power and enthrone good leadership for 2027," di govnors tok for dia communique afta dat meeting.
Rememba say na four opposition parties bin join bodi in 2013 to form di APC bifor dem fit take power from di PDP for di 2015 general election.
Di parties wey bin join togeda na di Action Congress of Nigeria (ACN), di Congress for Progressive Change (CPC), di All Nigeria Peoples Party (ANPP), and a faction of di All Progressives Grand Alliance (APGA).
Sabi pipo wey follow BBC Pidgin tok say e no go easy for dis kind join bodi of political parties to happen again, especially bicos PDP wey be di main opposition neva put dia house for order first.
"Di party dey face inside katakata now and dem no too strong agai, so e dey difficult for dem to win any elections. And e also dey difficult for pipo to join di PDP as e dey now sake of di internal crisis wey dem dey go thru," Professor Abubakar Kari of di University of Abuja, tok.
Professor Kari say since di PDP govnors no wan to merge wit oda parties, di best option for dem na to first quench di internal fire for di part, especially di division from some of dia top members wey be like say dem dey in bed di ruling APC.
One of dis pipo na former Rivers State govnor Nyesom Wike who even though e still be PDP member, na also cabinet member as Minister of di Federal Capital Territory, for di President Bola Tinubu APC administration.
Recently, tori bin also go round say President Tinubu don give some Wike loyalists appointments as ambassadors, even wen dem still be PDP members.
Wetin go be Atiku next move?
Former Vice President Atiku Abubakar na di main champion of dis join bodi idea and e don dey travel around di kontri to meet wit oda ogbonge politicians dem.
Atiku don meet wit Nasir El-Rufai, di former govnor of Kaduna State wey recently comot from di APC to join di Social Democratic Party (SDP). E also meet wit Peter Obi, di Labour Party presidential candidate for 2023, and former President Muhammadu Buhari who e go visit for im house for Kaduna last week.
For di 2023 election, Atiku wey bin contest on di platform of di PDP and Peter Obi of di Labour party, get a combined vote of more dan 13 million. Di APC wey win di election get just ova 8.7 million votes.
Supporters of di idea for merger say if Obi and Atiku join bodi, dem go easily beat Tinubu and di APC, but sabi pipo tink say di former Presido no dey do am di right way.
"Di position of di PDP govnors don show say Atiku no consult wit stakeholders for im party bifor e go ahead to dey seek merger wit oda parties," Professor Kamilu Sani Fagge, wey be lecturer of Political Science for Bayero University, Kano, tok.
"If Atiku no sidon wit di relevan stakeholders for di PDP and tok and agree, e go dey difficult for di governors to agree to follow am, and e go mean even more crisis for di party."
Oga Fagge say, wetin fit happen las las be say Atiku fit comot from di PDP.
"E bin don leave di PDP bifor and join APC. In fact, he follow for di ogbonge PDP members wey leave di party to di join di APC wen dem form am newly, so e fit do di same tin again," Fagge tok.
Abdulrasheed Shehu Sharada, one of di tok-tok pesin for Atiku tell BBC say di former President go still discuss wit di PDP govnors about im idea of join bodi wit oda parties.
"Atiku Abubakar dey capign for di opposition parties to come togeda to face di APC for di 2027 elections. Di discussions we dey get wit di oda parties now neva reach di point of which party to support, and we no dey plan to dissolve di parties to bicom one, but rather we dey seek dia support bifor di next election," Sharada tok.