A protester wit her hands up in front of a burning barricade in downtown Nairobi on June 25, 2025 during a planned day of protest to mark di first anniversary of di storming of di parliament

Wia dis foto come from, Luis Tato/AFP via Getty Images

Kenyans dey take to di streets again on Wednesday 25 June 2025, one year afta di GenZ protests wia dem storm di parliament for Kenya.

Dis na to mark di first anniversary of di June 2024 protests wey lead to deadly crackdown by police dat time, and death of some pipo.

Di protest today wey go hold for Kenya capital, dem brand am as a "memorial march," and na to honour dose wey dem kill during last year nationwide demonstrations against di controversial Finance Bill 2024.

Last year, young Kenyans lead protest, against one unpopular finance bill wey dem wan use to introduce new taxes.

Dem forcefully enta di parliament on 25 June 2024 and force di govment make dem drop di controversial proposals. Dat protest no end well.

Also, today protest dey gingered by ongoing public anger ova police brutality, including di death of teacher and blogger Albert Ojwang for police custody.

Also, di shooting of 22-year-old street vendor Boniface Kariuki during anti-govment demonstrations last week, dey also spark serious anger.

Di situation for Nairobi remain tense.

For June 2024, bold and new generation of young Kenyan protesters bin enta streets to force di goment to stop some of dia unpopular tax proposals.

Wetin happun be say Kenyan President William Ruto sign one new law wey require Kenyans to pay a 1.5% monthly tax to fund construction of low-cost houses, dem add VAT to bread including oda levies.

Dis vex di young citizens for Kenya and dem start from TikTok to tok about di controversial finance bill.

Dis na as hundreds of protesters wey feel say Kenyans dey already overtaxed wit little to show for am - face police wey fire tear gas - to march enta di capital, Nairobi.

Di govment of President William Ruto quickly cancel di finance bill.

Dat protest bring di city central business district to a standstill, but pipo die afta police shoot dem.

BBC bin identify di members of Kenya security forces wey shoot anti-tax protesters for di kontri parliament last June.

Di BBC analysis of more dan 5,000 images also show say dose wey dem kill for dia no get any weapon and dem no pose any threat.

Demonstrators march for downtown Nairobi on June 25, 2025 during a day of protest to mark di first anniversary of di parliament protest. A young man holding a placard, anoda man raise im hand wit mouth open, oda men for di background in protest

Wia dis foto come from, Luis Tato/AFP via Getty Images

On 17 June 2025, Kenyan protesters clash wit young men wey carry weapon - club - wey dey loyal to di govment, for di centre of di capital, Nairobi.

Di demonstration hapun afta di death of blogger and teacher Albert Ojwang for police custody 10, dem dey demand for di sacking of di top police officer.

Police bin tok say Ojwang die of self-inflicted wounds, but dem retract di statement afta autopsy find say e likely die afta assault. Dem don arrest two policemen in connection wit di death.

Meanwhile, tension dey ahead of di first anniversary of di parliament demonstrators.

We dey update dis tori