Log In

Wetin di lynching of travellers for Plateau state torchlight concerning insecurity for Nigerian roads

Published 11 hours ago4 minute read

Plateau State govnor Caleb Mutfwang wit victims

"I lose two sons and oda relatives because of dis wicked act by mob, my husband leave me with 13 children".

Na so Faji Sani, wey lose her pikin, husband and oda relatives for di attack on travellers for Plateau state tok. Mrs Sani dey ask di govment for justice and compensation.

Di recent killing wey happun for Mangu Local Government Area of Plateau State, North central Nigeria wia mob kill some travellers, don cause serious reactions in di kontri.

Di victims bin dey travel from Zaria for Kaduna State on Saturday to go attend wedding for Qua'an Pan Local Government Area of Plateau State, wen mob intercept dem for Mangun district.

Some of di travellers die for di scene, while odas sustain different kaind injury, and dem dey hospital now for treatment.

Authorities for Nigeria say about 13 pipo die afta some pipo ambush one bus wey belong to Ahmadu Bello University for Zaria.

Kaduna State Govnor, Senator Uba Sani, don condemn di killing as e describe di attack as "wicked and senseless" and e insist say dis kain tin no suppose go free witout punishment.

"No reason dey to attack any Nigerian for any part of di country" di govnor tell BBC Hausa.

"Dis kain wickedness suppose make everibodi vex, and dem must find dos wey do am and deal with dem well."

Govnor Sani tell im counterpart for Plateau State, Govnor Caleb Mutfwang, make e act, join hand wit security pipo so justice go happun.

"I go follow di investigation myself. We must show say impunity no go dey allowed again" im add.

President Bola Tinubu wey also condemn di killing say di attack dey "unacceptable and barbaric."

E don also order all security agencies make dem catch di pipo wey do am and carry dem go face justice.

"Freedom to waka anywia for Nigeria na right wey nobodi fit collect. We no go allow anybody or any group use violence or fear try stop citizens from moving freely."

Dis recent attack on travellers for Plateau state don bring up di tok about di safety of travellers for Nigerian roads, as e no be di first time e dey hapun.

Dis attack dey come months after anoda attack on travellers for Edo State, for southern Nigeria, wia mob kill some travellers - hunters - wey bin dey travel to Kano for northern Nigeria through Uromi.

For 2018, one Nigerian Army officer wey be former Chief of Administration, Major General Mohammed Idris Alkali (rtd), go missing wen e dey travel from Abuja go Bauchi. Later dem find im dead bodi for Plateau State, according to reports.

Wetin dey worrying now be say apart from bandits wey dey kidnap or kill pipo for road, if person dey travel for road, e fit still fall victim of mob lynching for Nigerian highways.

'Lack of consequence na part of wetin dey make lynching of travellers dey hapun'

Some pipo don chook eye say, di extra-judicial killings of travellers for Nigerian roads fit don come up as a result of di rise of insecurity and persistent attacks on communities by armed men, weda dem be herdsmen or bandits.

But security expert, Auwal Bala, wey be Senior Private Security Consultant for Borno State, believe say di main reason why pipo dey lynch travellers for Nigerian roads na sake of say, dos wey dey do am no dey face punishment.

E tell BBC Pidgin say, some of di mobs wey dey do dis kind tin get political, ethnic or religious reasons behind am.

"Some dey do am sake of politics, religion, some becos of tribe, but anyhow e be, nobody get right to kill person just like dat even if di person commit offence" oga Bala tok.

E also tok say even wit all di insecurity kasala wey dey Nigeria now, pipo no suppose take law for dia hand.

"You no fit just dey kill travellers sake of your area dey face security wahala, you suppose consult or confirm who dem be.

Even if dem be suspect, carry dem go police or authorities pipo no suppose dey use insecurity as excuse" e tok.

Wetin fit be di solution?

Di security analyst tok say di only way to stop dis kain attack on travellers na if goment and court begin punish pipo wey dey do am, witout looking face, tribe or religion.

Dr. Bala talk say, "di solution be say anybody wey do dis kain tin, make dem carry am go court, and make dem punish am well based on wetin e do."

"Make dem no bring politics, religion or tribe inside. Anybody wey commit crime, make e face di consequences.

"Judges too no suppose dey soft, make punishment strong so odas go fear and no go try am" e add.

Burial of pipo wey die

One of di victims wey survive di Plateau state attack

Origin:
publisher logo
GhanaWeb
Loading...
Loading...
Loading...

You may also like...