Mark Carney

Wia dis foto come from, Getty Images

Mark Carney don dey appointed as Justin Trudeau replacement afta Trudeau resign as prime minister and Liberal Party leader sake of political division for di party.

For im introductory speech afta im election, e tok say Canada no go dey part of America at all at all.

E tok about how America dia neighbour no dey trustworthy again, di American tariffs, di secure borders issue and wetin dey happun for Canada politics.

Dis na four of di tins wey im tell im Liberal supporters:

Wetin we call dis Video, Watch: 'Canada no go ever, ever dey part of America' - Mark Carney

For most of im victory speech, 59-year-old Carney attack Trump wey say e wan make Canada di 51st American state.

E say, "Di Americans want our resources, our water, our land, our kontri. If dem succeed, dem go destroy our way of life."

"Donald Trump tink say e fit weaken us wit im plan to divide and conquer."

E add say, "I know say dis na dark days wey kontri wey we no fit trust again carry come".

"We dey get ova di shock but make we no forget di lessons, we need to look afta oursefs and we need to look out for oursefs. We need pull togeda for di rough days we dey in front."

Canada Conservative party leader Pierre Poilievre

Wia dis foto come from, Reuters

Wetin we call dis foto, Canada Conservative party leader Pierre Poilievre bin dey accused say e dey "serve for Donald Trump altar"

Carney take style use di US president take yab im main opponent, Conservative leader Pierre Poilievre.

E say "Pierre Poilievre plan go leave us divided and ready to dey conquered becos pesin wey worship for altar of Donald Trump go kneel for am and no go stand up to am".

Carney dey expected to call for snap elections and if e no do am di Conservatives go call di election wit vote of no confidence.

Alreadi di opposition party don dey attack Carney say e dey "just like Justin (Trudeau)".

Most of Carney speech torchlight wetin e call Trump "unjustified tariffs" for Canada wey be America biggest trading partner.

Dis US bin sama levies of 25% on top Canadian goods last Tuesday but later do about turn to comot di goods wey bin dey under one existing trade agreement.

Canada do dia own back wit dia own tariffs wey dem put for ground as Trudeau accuse Trump say e dey try collapse di kontri economy.

Carney say e for keep di do-me-I-do-you tariffs till "Americans show us respect".

E say e go make sure say "di tariffs get maximum impact for Americans and minimal impacts for us".

Alreadi, tori don dey comot from Canada say some kontri pipo don alreadi dey stop to dey buy products wey dey come from America as sign of patriotism.

Carney also promise say e go "secure our borders".

Dis na one of of di koko demands wey Trump put for ground wen e accuse Canada say dem fail to control how migrants and fentanyl dey go south.

Dis na di reason wey di American president bin put di tariffs wey don dey cause wahala on Canada for ground.