Justin Trudeau, Claudia Sheinbaum react as Trump impose tariffs on Canada and Mexico - BBC News Pidgin
Wia dis foto come from, Getty Images
US President Donald Trump don announce sweeping new tariff for all di goods, US dey import from America three largest trading partners wey be China, Mexico and Canada.
Trump tok say US go start to dey impose di tariffs from Tuesday. Dat na 25% on Canada and Mexico and additional 10% tax on China. Canada energy go face 10% tariff.
E bin threaten to impose di import taxes if di three kontris no address im concerns about illegal immigration and drug trafficking.
Both Canada and Mexico tok say dem dey plan to do dia own back wit dia tariffs.
Trump don indicate say e ready to increase import duties more and more if di kontris do dia own back.
Skip Recommended articles and continue reading
End of Recommended articles
Togeda, China, Mexico and Canada bin make up ova 40% imports wey enta di US last year.
Di White House for statement wey dem release to X on Saturday tok say, "today tariffs announcement dey necessary to hold China, Mexico and Canada accountable for dia promise to stop di flood of poisonous drugs wey dey enta di United States".
Trump post for im Truth Social platform say, "dis bin dey don through di International Emergency Economic Powers Act (IEEPA) bicos of di major threat of illegal aliens and deadly drugs wey dey kill our pipo wey include fentanyl".
Tariff na domestic tax wey dem dey put on goods as dem dey enta di kontri wey dey valued based on di value of di import. Na im be di koko of Trump economic vision.
E see dem as way to grow di US economy, protect jobs and raise tax revenue and for dis case, na to push policy actions from dia allies.
Di White House for dia announcement accuse Mexico goment say dem get "intolerable alliance" wit Mexican drug trafficking joinbodies.
Mexican President Claudia Sheinbaum call di accuse say di Mexican goment get collabo wit criminal organisation say na "slander".
Sheinbaum call di US make dem do more to clamp down on di illegal flow of guns wey dem come south to arm di cartels.
She say her kontri dey willing to work wit di US. "Problems no go dey solved by imposing tariffs but by tok-tok."
She don instruct her economy minister to ansa back wit tariffs and non-tariff measures. Dem dey expected to include do-me-I-do-you tariffs of 25% on US goods.
Canada Prime Minister Justin Trudeau say im kontri go also respond.
E tok for news conference on late Saturday say, "We no wan dey hia, we no ask for dis. But we no go back down to stand for Canadians".
Im goment go impose 25% tariffs for $155bn work of American goods. $30bn go start on Tuesday and anoda $125bn in 21 days.
Di items wey go dey targeted include American beer, wine, bourbon, fruits and fruit juices, vegetables, perfumes, clothing and shoes plus including household appliances, sporting goods and furniture. Lumber and plastics go also face levies.
Non-tariff measures wey dem dey reason dey related to critical minerals and procurements although Trudeau no really tok about am.
Di Canadian prime minister also push back on di security concerns around dia border say na less of 1% of di fentanyl wey dey enta US dey come from Canada.
To avoid di tariffs pata-pata, Ottawa don promise to implement $1.3bn Canadian dollars ($900m; £700m) of new security measures for dia border wit US.
E also say e neva follow trump tok since di inauguration but go keep di lines open wit di US.
Canada na America biggest foreign supplier of crude oil. According to most recent official figures 61% of di oil US import between January and November bin come from Canada.
China tok for statement say dem firmly oppose di levies. Dis 10% na addition to di tariffs wey Trump bin impose for im first term and di ones wey President Joe Biden add on top.
Dem add say dem go file lawsuit wit di World Trade Organisation against di US for dia "wrongful practice "and go arrange plans to "safeguard dia own rights and interests".
China Vice-Premier Ding Xuexiang bin tell di World Economic Forum in Davos, Switzerland, last month say im kontri dey find win-win solution to trade tensions and wan expand dia imports.
Canada, Mexico and di US get close economies as na around $2bn (£1.6bn) dey cross dia border evriday.
Economists say gbas-gbos on tariffs for raise prices on products from cars, lumber, and steel to food like frozen French fries, avocados, and tomatoes, to alcohol.
On Friday Trump tok say true-true, dia fit be "some temporary, short term disruption" sake of di tariffs.
Di Canadian Chamber of Commerce bin release statement say tariffs go get "immediate and direct consequences on Canadian and American livelihoods" and go "drastically increase di cost of evri tin for evri bodi".
US industry groups too don dey hala.
Di National Homebuilders Association say di levies fit increase house cost.
Di Farmers of Free Trade tok say US farmers don alreadi dey suffer "to add tariffs inside go only make am worse for much or rural America."
Di US Retail Industry Leaders Association, wey get big names like Home Depot, Target and Walgreens as part of dia ova 200 members dey hope say di tariffs fit still dey removed.
Di White House explain on Saturday say why dem dey target dia top trading partners na bicos Mexican cartels na dem dey responsible for di trafficking fentanyl, methamphetamine and oda drugs.
Dem tok say Canada tariffs go stay till dem "co-operate wit di US against drug traffickers and border security."
Lastly dem say "China dey play central role for di fentanyl crisis" wit exports of di synthetic painkiller.
Official data report drug seizures from both di northern and southern US borders even though di ones for Canada at 43lbs (19.5kg) of fentanyl, small pass di ones from Mexico wit ova 21,000lbs (9,525.4kg) between October 2023 and last September.
Still recent reports from Canada intelligence agencies suggest say growing number of transnational organised crime groups dey manufacture drugs for Canada.