South Sudan: UN helicopters shot down as White Army Militia and South Sudan Defence Forces clash - BBC News Pidgin
Wia dis foto come from, Unmiss
Plenty pipo don die for South Sudan afta one attempt by di UN to evacuate members of di national army come under fire, di UN confam.
One crew member die wen dem shoot at one UN helicopter, statement from dia mission for South Sudan, Unmiss, tok.
Di statement add say one injured South Sudanese general plus several oda troops die during di evacuation attempt for Upper Nile state.
Di UN tok say di attack on dia helicopter "fit constitute a war crime".
South Sudan President Salva Kiir later say one second helicopter wey manage to take off afta di attack, crash land, and kill evri body wey dey on board.
But Unmiss bin tok say both dia aircraft bin land safely for Malakal.
Di Information Minister, Michael Makuei wey Reuters news agency quote tok say twenty-seven South Sudanese in total na im die.
Weeks of fighting for Upper Nile don threaten di already fragile peace deal between President Kiir and Vice-President Riek Machar.
For 2013, di I no go gree between di two of dem bin spark five-year civil war, wey don lead to di death of 400,000 pipo and force 2.5 million pipo to comot dia homes.
Dem sign peace agreement for 2018 but di situation no calm down ever since.
Di ongoing fighting for Upper Nile na between di armed forces and di White Army, one ethnic militia wey bin collabo wit Machar during di war.
In agreement wit di White Army and South Sudan army, Unmiss dey carry wounded troops from di conflict zone comot.
Unmiss head Nicholas Haysom tok for statement say di attack on dia mission personnel dey "extremely abhorrent and e fit constitute a war crime under international law. We deeply regret di tragic loss of our colleague and express our sincere condolences to im loved ones.
"We also regret di killing of those wey dey try to extract, particularly wen we don receive assurances of safe passage."
President Kiir tok say di army general wey die for di attack na Gen Majur Dak, wey lead di forces wey station for Nasir, one region for Upper Nile.
Alongside di fighting, authorities don make some arrests wey dey spark concerns say South Sudan fit see a return to war.
A number of Machar allies, wey include di oil minister and one high-ranking army general, bin dey detained earlier dis week.
Afta Friday attack, Kirr urge di nation to "remain calm".
"I don tok am time and again, say our kontri no go, go back to war. Make no-one take di law into dia own hands. Di goment, wey I dey lead, go handle dis crisis," e tok.
South Sudan na di world newest nation, afta dem comot from Sudan for 2011.