Log In

Naija get di second-highest nomba of pipu wey get HIV for di world?

Published 1 month ago3 minute read

Aproko Doctor share di claim for im X handle, wey get like 2.3 million followers.

Im bin dey chuk mouth for US President Donald Trump executive decision to cancel moni for HIV treatment for kontris wey still dey develop.

As Trump give di executive order, di US Department of State suspend di moni wey dem bin dey give from di president’s emergency plan for AIDS relief (PEPFAR).

, PEPFAR dey provide HIV treatment for more dan 20 million pipu wey dey live wit di disease for di world, including 566,000 children under 15 years of age.

For di post, di medical influencer bin dey explain how di money wey US govment cancel to treat HIV go affect how antiretroviral drugs go dey available.

Wen dem challenge Aproko Doctor about di source of im informate, im share screenshot of report from di United Nations Children’s Fund (UNICEF) website.

“Nigeria get di second highest nomba of pipu wey dey live wit HIV for di world,” na so

, UNICEF tok sey Nigeria get 190,950 HIV/AIDS infections per year – di second highest rate for di world. Di global bodi tok sey Nigeria get di world’s second-highest burden of HIV/AIDS, wit an estimated three million people wey dey live wit HIV. Di article show sey di informate wey UNICEF quote na since 2015.

E dey necessary to understand sey di burden of di virus dey different from di informate of pipu wey dey live wit am. Di HIV burden na di overall impact of di virus, including di nomba of pipu wey dey live wit di virus, di rate of new infections, and di deaths caused by di virus, among odas.

To confam di mata, CableCheck look di As of 2023, di dashboard show informate about pipu wey dey live wit HIV for at least 134 countries.

Di informate show sey South Africa get di highest nomba of pipu wey dey live wit HIV, wit 7.7 million individuals, followed by India at 2.5 million, Mozambique wit 2.4 million, and Nigeria as nomba four wit 2 million.

Country Number of Persons Living With HIV
South African 7,700,000
India 2,500,000
Mozambique 2,400,000
Nigeria 2,000,000
United Republic of Tanzania 1,700,000
Uganda 1,500,000
Kenya 1,400,000
Zambia 1,300,000
Zimbabwe 1,300,000
Brazil 1,000,000

Table wey show di top 10 kontris wit di highest nomba of pipu wey dey live wit HIV.  Informate: WHO 

Dis informare mean sey Nigeria get di fourth-highest nomba of pipu wey dey live wit HIV globally and di third-highest for Africa.

, approximately 39.9 million people bin dey live wit HIV at di end of 2023. Di report no give di breakdown of informate for each kontri. Howeva, an estimated 26 million pipu wey dey live wit di virus dey Africa.

Di claim wey tok sey Nigeria get di second-highest nomba of pipu wey dey live wit HIV for di world no correct. Recent informate from di WHO show anoda tin.

Origin:
publisher logo
TheCable Fact Check
Loading...
Loading...

You may also like...