Gastroenteritis: Mbappe land hospital sake of infection for im gut - BBC News Pidgin
Wia dis foto come from, Getty Images
Real Madrid forward Kylian Mbappe land for hospital sake of gastroenteritis afta e miss di Club World Cup opener against Al-Hilal.
Di France captain wey dey 26 years bin miss training on Tuesday wit fever and im no play on Wednesday wen im club play 1-1 draw against di Saudi Arabian side.
One statement from Real on Thursday say Mbappe get "serious case of gastroenteritis" and dem admit am for hospital for "series of tests".
Real next game na against Pachuca on Sunday
Depending on how Mbappe respond to treatment, im fit miss di game but fit potentially return for Real Madrid final group game against RB Salzburg on 26 June.
Mbappe score 43 goals in 56 games for all competitions for Real for im first season afta e join on a free transfer from Paris St-Germain.
Dis na Real first competition under Xabi Alonso, wey replace Carlo Ancelotti as manager wen di La Liga season end.
Real win di Uefa Super Cup and Fifa Intercontinental Cup for Mbappe first season for Spanish football.
Gastroenteritis na infection for di gut wey fit cause vomiting and diarrhoea.
According to di National Health Service, NHS, na bacteria or viral tummy bug dey usually cause di sickness.
E dey affect pipo of all ages, but e dey common among young children.
For most cases wit children, na rotavirus dey cause am while norovirus (di 'winter vomiting bug') dey cause di sickness for adults or bacteria from food poisoning.
Gastroenteritis no dey good at all, but e dey usually clear up by imsef within one week.
You fit do your normal work or look afta yourself until you well.
If pesin get di sickness, sabi pipo say make dem no waka anyhow becos di disease dey easily spread.
Di main symptoms of gastroenteritis na sudden, watery diarrhoea, you go start t feel sick. You go begin vomit and you fit get mild fever.
Some pipo fit get oda symptoms like loss of appetite, and stomach upset, your limbs go dey pain you plus headaches.
Di symptoms dey usually appear up to a day afta pesin catch di disease. E dey last for one week but for some pipo e dey pass one week.
E no get any specific treatment, so you need to let di sickness expire by e sef.
You fit no need medical advice, unless your symptoms no improve or you get risk of a more serious problem.