Elias Rodriguez: Gunman shoot two Israeli embassy staff dead near Jewish museum for Washington DC - BBC News Pidgin
Wia dis foto come from, Embassy of Israel to the USA
Di Israel embassy for di US don name di couple wey gunman bin shoot dead for Washington as Yaron and Sarah.
Israeli media report say dia full names na Yaron Lischinsky and Sarah Milgram.
Di victims "bin dey for di prime of dia lives," di embassy post on X, external.
"A terrorist bin shot and kill dem as dem bin dey comot from di event for di Capital Jewish Museum for DC," e tok.
Di embassy say dia staff dey "heartbroken and devastated" by di murder.
"No words fit express di depth of our grief and horror for dis devastating loss. Our hearts dey wit dia families, and di embassy go dey by dia side during dis terrible time."
Levi Shemtov na rabbi for Washington wey bin don meet di couple before.
Im tell BBC Radio 4's Today programme say im bin see di couple for di Jewish events for di city.
Dem be "nice pipo, popular" pipo im tok, and dis na "brutal news".
Jewish community organisations don beef up dia security in recent years, im tok, and "especially afta 7 October", wen Hamas bin attack Israel, killing about 1,200 pipo and taking ova 250 hostages.
Di attack bin triggered a massive Israeli military offensive for Gaza, wey bin kill tens of thousands of Palestinians.
"We get armed guards for di [synagogue] services evri week," Shemtov tok, im add say dem go increase security even more now.
Wia dis foto come from, Reuters
Gunman bin shoot di two Israeli embassy staff dead near a Jewish museum for Washington DC, according to US Homeland Security Secretary Kristi Noem.
Police don identify di suspect as Elias Rodriguez from Chicago, Illinois. Dem also don detain am.
Di two pipo wey die na young couple wey dey about to engage, Yechiel Leiter, Israel ambassador to di US tell tori pipo.
"Di young man buy ring dis week wit di intention of proposing to im girlfriend next week for Jerusalem.
"Dem be beautiful couple," Leiter tok.
US Homeland Security chief Kristi Noem don vow to "bring dis evil perpetrator to justice" while Israel ambassador to di UN call di incident a "wicked act of anti-Semitic terrorism".
Dem see di 30-year-old Chicago man dey "waka upandan outside di museum" wia di shooting happun.
E bin approach a group of four pipo and bring out handgun, na so e shoot di two pipo.
Rodriguez now dey in custody and DC Mayor Bowser don tok say "active threat in our community" no dey.
Di suspect chant "free Palestine, free Palestine" while in custody, Washington police chief Pamela Smith tok.
US President Donald Trump don condemn di killings and suggest say na antisemitism dey ginger dem.
"Diz horrible D.C. killings, dey based obviously on antisemitism, e must end, NOW! Hatred and Radicalism no get place for USA," e write on Truth Social, im platform.
"Condolences to di families of di victims. So sad say such tins as dis fit happen! God Bless You ALL!" Trump write.
Wia dis foto come from, Reuters
Meanwhile di Israeli Prime Minister Benjamin Netanyahu says dem go increase security for all Israeli representatives and for dia diplomatic missions worldwide.
"My heart aches for di families of di beloved young man and woman wey heinous antisemitic murderer cut dia lives short" im tok.
"We dey witness di terrible price of antisemitism and wild incitement against di state of Israel."
A statement from di prime minister office say im bin don spoke wit di US attorney general Pam Bondi and Israel ambassador for di kontri.
Di President of Israel Isaac Herzog don respond to di killing of di two young pipo. Im say im dey "devastated" by di shooting.
"Dis na despicable act of hatred, of antisemitism," im write on X. "Our hearts dey wit di loved ones of those murdered and our immediate prayers dey with di injured."
Im add say im dey send im "full support" to staff for di embassy and stands wit di Jewish community for di US.
"America and Israel go stand united in defence of our pipo and our shared values. Terror and hate will not break us," im write.
Di event organiser, Jojo Kalin wey organise di American Jewish Committee event for di Capital Jewish Museum for Washington DC tok say di attacker return to di museum afta di shooting.
She tell di BBC Today programme say she bin see di attacker inside di building, looking "very distraught" afta di shooting.
"Di security allow dis pesin enta tinking say dem be bystander or witness," she tok.
Jojo bin give am water becos im bin look distressed, but she bin no see any weapon.
At dat point, "he bring out im red Jordanian keffiyeh and im shout Free Palestine."
She say di aim of di event na to build coalitions for di Middle East, and e dey "deeply ironic say wetin we bin dey discuss na bridge building and den dem hit ova our head wit such hatred".
Dem organise di event wey be evening cocktail for young Jewish professionals to foster unity and celebrate Jewish heritage.
Di organiser, American Jewish Committee, say di event bin dey open to pipo wey dey for di DC diplomatic community.
Di theme of di event na "turning pain into purpose".
According to di event description, dem bin invite special guests like humanitarian aid organisers wey dey respond to humanitarian crises for di Middle East, including Gaza.
While dem bin publicly advertise di time of di event, dem only share di location wit pipo wey bin sign up to attend.
Wia dis foto come from, EPA
Wia dis foto come from, EPA
Wia dis foto come from, AFP VIA GETTY IMAGES