Log In

Wetin be di Scholarship opportunity wey Tinubu wan give Carribbean students for Nigeria University

Published 12 hours ago3 minute read

Tinubu announce schorlaship opportunities for nigerian students wey dey come from OECS

Nigeria President Bola Tinubu don announce scholarship opportunities for Nigerian universities for students wey dey come from di Organisation for Eastern Carribbean States (OECS).

According to di statement wey im make for joint statement wit di Prime Minister of Saint Lucia, Philip J. Pierre, say di initiative don start already but go start well for di next academic year.

Di initiative na collabo wit di OECS leadership and go run am as joinbodi committee wit reps fro Nigeria and OECS member states.

President Tinubu torchlight dis plan as part of di larger work dem dey do to fit strengthen di pipo-to-pipo ties and increase opportunities for education, trade and development.

Prime Minister Pierre call di scholarship say na timely and practical expression of solidarity.

Dis visit bin start on Saturday and na di first leg of President Tinubu two-nation trip to di Caribbean and South America.

Im dey expected to enta di Sir Arthur Lewis Community College for Castries to strengthen educational ties and promote academic exchange.

Dem neva give informate about how di scholarship go work out between di OECS and Nigeria go work.

But for di joint press briefing both kontri leaders dem tok discuss proposal to bounce visa for pipo wey get diplomatic and official passports from OECS member states still dey come.

President Tinubu also torchlight say e now dey di joint committee hand to handle di mata of finalising wetin dey to finalise so di beneficiaries go fit start to dey study for Nigerian schools for di upcoming academic year.

For di OECS Commission statement about di trip wey Tinubu make to Saint Lucia, dem na di initiatives wey dey in di works say e include: visa waiver, scholarships to OECS citizens, services of di Nigerian Technical AId Corps and Formal diplomatic relations

Dis decision dey come ova one month afta di Nigerian goment cancel foreign scholarship scheme wey dem dey call Bilateral Education Agreement (BEA) Scholarship Programme. Di Minister of Education, Tunji Alausa tok say di move dey come to ginger or boost di local education.

Dem howeva say dem dey make di money for di pipo wey currently dey under to dey available.

Wetin be di OECS

Di OECS na twelve member group of islands wey dey around di Eastern Caribbean.

Dem get 12 member states include Antigua and Barbuda, Commonwealth of Dominica, Grenada, Montserrat, Saint Kitts and Nevis, Saint Lucia, Saint Vincent and di Grenadines, British Virgin Islands, Anguilla, Martinique, Guadeloupe, and Saint Martin.

Dem group bin star for 18 June 1981, wen seven Eastern Caribbean kontris collabo sign treaty to gree say dem go cooperate and promote unity and solidarity among di Members.

Origin:
publisher logo
GhanaWeb
Loading...
Loading...
Loading...

You may also like...