A man in dirty clothes holds up a wooden box of unexploded munitions to the camera. He stands beside a muddy car.

Wia dis foto come from, Reuters

Wetin we call dis foto, One Sudanese man show a box of unexploded munitions wey dem find for one school in Khartoum, di kontri capital

Di US go impose new sanctions on Sudan afta dem find say dem use chemical weapons last year in di ongoing civil war against di Rapid Support Forces (RSF), di state department don tok.

US exports to di kontri go dey restricted and financial borrowing limits go dey in place from 6 June, statement from tok-tok pesin Tammy Bruce read.

In response a Sudanese govment tok-tok pesin strongly condemn di move by Washington, describe am as a "deliberate distortion of facts concerning di situation in Sudan".

Both di Sudanese military and di paramilitary group di RSF don dey accused of war crimes during di conflict before now.

More dan150,000 pipo don die during di conflict, wey start two years ago wen Sudan army and di RSF begin one brutal struggle for power.

In recent months, Sudan military don recapture di capital of Khartoum, but fight dey kotinu for anoda place.

No detail dey about which chemical weapons di US say dem find, but di New York Times bin report in January say Sudan bin use chlorine gas on two occasions, wey cause different painful and damaging effects and fit dey fatal.

Dis, dem tok say bin don dey for remote areas wey dem no give dia names. Dem neva share share any visual evidence so far as proof of di weapons as e don dey used in di current war in Sudan.

"Di United States call on di govment of Sudan to cease all chemical weapons use and uphold im obligations under di CWC," di statement read, referring to di Chemical Weapons Convention under which signatories don commit to destroy dia stockpiles of di weapons.

Nearly evri kontri in di world - including Sudan - don agree to di CWC, apart from Egypt, North Korea and South Sudan according to di Arms Control Association, a US-based non-partisan membership organisation. Israel don sign di agreement but no ratify im signature, dis mean say dem neva legally confam dia involvement in di treaty, di ACA add.

"Di United States remain fully committed to hold to account those wey dey responsible for di contribution to chemical weapons proliferation," Bruce add.

Dis no be di first time wey di US don impose sanctions in Sudan. In January, dem knack leaders of both parties wey dey di konflict wit sanctions.

Sudan military leader Abdel Fattah al-Burhan bin chop accuse say e dey "destabilise Sudan and undermine di goal of a democratic transition" by di US, wey di kontri foreign ministry condemn as "strange and troubling".

Meanwhile, di head of di RSF Mohammed Hamdan Daglo, wey also dey known as Hemedti, dey determined to get perpetrated genocide in di kontri by former secretary of state Antony Blinken. Di RSF don deny dis charges.

Di rival forces don dey struggle for power for di past two years, displace around 12 million pipo and leave 25 million to need food aid, more dan double di population of London.

New sanctions go get small effect on di kontri sake of dis prior measures, according to di AFP news agency.

Dis latest US move dey come as tensions over di alleged involvement of di United Arab Emirates in di conflict.

Di UAE and Sudan bin don maintain diplomatic ties until earlier dia month wen di Sudanese govment allege say di UAE bin provide arms to di RSF, allegation wey UAE deny.

Following US President Donald Trump warm reception in di Gulf state last week, Democrats in Congress dey try to block di sale of arms from di US to di UAE in part sake of im alleged involvement in di conflict.

One Sudanese diplomatic source bin tell news agency Reuters say di US don impose di new sanctions "to distract from di recent campaign in Congress against di UAE".

Earlier dis month, one top UN court bin reject Sudan bid to sue di UAE for genocide.