Log In

'Peter Obi no go ever be president' - Wike

Published 9 hours ago3 minute read

Nyesom Wike (L) and Peter Obi

Nigeria Minister of di Federal Capital Territory (FCT), Nyesom Wike say, 2023 Labour Party presidential candidate Peter Obi no go ever be president of di kontri.

Di one time govnor of Rivers State, tok dis one during one thanksgiving wey dem do for project inauguration for Abuja.

Wike, one of di close allies of President Bola Tinubu, tok dis one as im dey react to one new coalition party wey some heavy weight politicians wit presidential ambition form as opposition to di ruling All Progressive Congress (APC) party.

E say, "You say Peter Obi go be president. President wia? Some of una no sabi somebody, una go just dey tok out of emotion."

Di minister also drag oda coalition members Atiku Abubakar, Rauf Aregbesola and odas.

Oga Wike kwesion why former vice president of di kontri and di 2023 presidential candidate of di Peoples Democratic Party dey jump from one party to anoda.

"How Nigerians no go vex for you today. For 1999 you dey dis party. For 2006 you dey anoda party, for 2014, you move go anoda party. In 2019 you go back to anoda party. Now 2025 you dey go anoda party. To rescue who?" Wike ask.

E tell former minister of interior, Arebesola say n aim Nigerians dey angry wit becos im make dem wait for many many months before dem for fit get dia international passport.

Di minister declare say as all of dem don comot from power, dem no go come back.

Who dey behind di party

Na for 2005 Ralph Nwosu establish di Alliance for Democratic Change.

Di party later change name to African Democratic Congress.

Inec register dem in 2006 ahead of di 2007 general elections wia di party bin get candidates but dem no win any position.

From di 2007 general election till date, di ADC don dey field presidential candidates for each election, as follows:

Patrick Utomi - 2007

Rev Peter Uchenna Nwangwu - 2011

Dr. Mani Ibrahim Ahmad - 2015

Obadiah Mailafia - 2019

Dumebi Kachikwu - 2023

Di ADC primary election for di 2023 general election bin cause plenty controversy sake of two big aspirants - former deputy guvnor of Central Bank of Nigeria, Kingsley Moghalu and Dumebi Kachikwu.

Eventually, Kachikwu win di primary and contest di election wia e get only 78,930 votes.

As politicians all over di kontri dey ginger to hit some master strokes for di political landscape, some heavyweights gada dem sef form ADC.

Di believe be say ADC go be di anchor party for di opposition coalition as dem wan try remove President Tinubu from office for di 2027 general election.

Pipo dey hail di party wey former Senate President David Mark, and former govnor of Osun State Rauf Aregbesola dey head as interim national chairman and secretary of di party, as ogbonge move wey di opposition politicians don make so far.

But e still get many pipo wey get questions about dis ADC party, how e come into existence, dia performance for former elections, and why dem chose am as di vehicle wey go carry di coalition.

Dem also question how dis party want take work as e be say all di big politicians dia, most of dem wan become di next president.

Origin:
publisher logo
GhanaWeb
Loading...
Loading...
Loading...

You may also like...