Log In

No, Nigeria no send peace support mission go Israel

Published 8 hours ago2 minute read

One male broadcaster wey dey report for one outlet identified as TBC News make di claim for di 30-second video.

“Nigeria dey proud to extend im strategic defence training to key global allies,” na so one army officer wey appear for di video tok.

“Na friendship mission be dis no be war.

“Di soldiers go participate for solidarity programme wey dey designed to enhance global cooperation and international alliance.”

Di male broadcaster tok sey international observers praise di initiative, as symbol of African leadership for global defence collaboration.

Di broadcaster tok sey di tin hapun on Tuesday, June 17th.

At di time of dis tori, di video don gada 3.2k likes, 506 shares, and 465 comments.

Di video come at a time wen tensions between Israel and Iran increase, as di conflict enter second week.

Kontris, including Nigeria, and global leaders shown concern and call for calm.

But na true sey Nigeria chuk hand for di mata by sending joint peace support mission go Israel?

CableCheck do keyword searches of di so called deployment ontop search engines and we no find any tori wey gree for di claim,

Di presidency, ministry of defence, and di Defence Headquarters (DHQ) no issue statement sake of di mata.

CableCheck try folo Edward Buba, DHQ chief informate, tok but im no ansa.

No beta media platforms report di mata.

CableCheck also notice sey some tins wey resemble artificial intelligence (AI) hand dey show for di broadcaster bodi.

For di first seven seconds of di video, di broadcaster dey wear blue suit and im head no get hair. For di last seconds, im suit change colour to darker blue colour, im knack red tie, and hair come suddenly grow for di head.

Di narrator voice bin get consistent speed, flat, and im dey pronounce im words like computer— all dis tins na so AI voice be.

Howeva, on June 20, di Nigerian armed forces at least 197 troops go ECOWAS mission for Gambia (ECOMIG).

FINAL TOK

No beta evidence show sey Nigeria send soldiers go peace support mission for Israel.

Origin:
publisher logo
TheCable Fact Check
Loading...
Loading...
Loading...

You may also like...