Niger coup: President Mohamed Bazoum still dey detention as Niger junta release 57 prisoners - BBC News Pidgin
Wia dis foto come from, EPA
Di military goment for Niger Republic don release 57 prisoners, including former ministers from President Mohamed Bazoum, wey dem bin pursue from office by force goment.
But President Bazoum still dey for detention, and dem no know wetin go happun to am.
Di release na part of recommendations from one national conference for February, wey extend General Abdourahamane Tchiani rule by five years .
Wen di BBC ask about President Bazoum detention, Justice Minister Aliyou Daouda tok about "national security and sovereignty" concerns.
'Di kwesion of im release na internal mata for Niger and only concern Niger,' Justice Minister Aliyou Daouda bin tell di BBC.
Dem bin arrest di prisoners afta di July 2023 coup wey bring General Abdourahamane Tchiani to power.
Di former head of di presidential guard na im bin order dia detention for various prisons, for alleged "conspiracy to undermine di security and authority of di state".
Di pipo wey dem release include, former Oil Minister Mahamane Sani Issoufou, di son of former President Mahamadou Issoufou, former finance minister Ahmat Jidoud and former energy minister Ibrahim Yacoubou
Odas na former defence minister Kalla Moutari, former ambassador to Nigeria Alat Mogaskia and journalist Ousmane Toudou.
Dem also release all di sojas wey dem bin sama accuse for coup attempts for 2010 and 2015.
Dis move could fit be an attempt by di junta to reconcile di kontri and gain popular support.
Di military goments of Burkina Faso and Guninea bin don give dis type of amnesty too.
Gen Abdourahamane Tchiani bin don dey lead di kontri since 2023, afta e remove Niger elected President, Mohamed Bazoum through coup.
Gen Tchiani take di presidential office under one new charter wey replace di West African kontri constitution.
Dem also promote am to di kontri highest military rank of army general, and e sign one decree wey order di dissolvement of all political parties.
For one ceremony for di capital, Niamey, Gen Tchiani tok about im new military rank. "I receive dis distinction wit great humility... I go try to live up to di trust kontri pipo place in me."
Wit all di kasala wey dey happun for di goment of Nigeri, dem still get hope to go back to democracy rule wey fit happun anytime within di five years.
Di transition to democratic rule also dey in line wit recommendations from one commission afta one national discussion.
Dis five-year time period dey "flexible" and e depend on di kontri security status, di new charter tok.
Niger na one of di sub-saharan African kontris wey dey face serious insecurity issues.
Jihadist attacks bin dey worry Niger for many years – and na one of di issues wey di junta leaders bin cite wen dem stage di coup.
Di military takeover bin follow odas for di region – na juntas too bin lead dia neighbours Mali, Guinea and Burkina Faso as dem collabo comot from Ecowas.
Demm call dia own group Alliance of Sahel states and dem dey do tins togeda now.
All di four kontris don cut ties wit former colonial power France and dem don forge new alliances wit Russia.