Vladimir Putin and Donald Trump

Wia dis foto come from, Reuters

Wetin we call dis foto, Putin and Trump pictured together at a summit in Vietnam in 2017

Three years don pass since Russia launch full-scale invasion for Ukraine and try seize Kyiv.

For dat invasion, Russia collect more dan 4,000 square kilometres of land, and both sides don lose thousands of pipo most of dem be military personnel.

US President Donald Trump do 90-minute phone call yesterday wit Russia President Vladimir Putin.

Di call lead to plenty big announcements wey fit change di war mata.

Here na some key points of wetin e tok:

• Trump tok say e and Putin don agree say make dem start peace tok to end di Ukraine war "immediately".

• Di two leaders invite each oda make dem visit dia capitals.

• Trump tok say e no go dey "practical" for Ukraine to join Nato, and e dey "ok" wit dat.

• Trump agree wit Defence Secretary Pete Hegseth say e no likely say Ukraine go fit get back all dia land wey Russia take bifor 2014, but wen BBC ask am, e tok say "some of dat land go come back".

Meanwhile, Ukraine President Volodymyr Zelensky sef do one-hour phone call wit Trump.

Kyiv tok say Zelensky yarn wit di US president about how to create "lasting, reliable peace".

Zelensky tok say dem "agree to maintain further contact and plan upcoming meetings".

UK Defence Secretary John Healey

Wia dis foto come from, Reuters

Wetin we call dis foto, UK Defence Secretary John Healey

UK Defence Secretary John Healey don react to Trump tok on Ukraine war as Nato defence ministers dey gada for Brussels.

E say Nato job na "to put Ukraine for strongest possible position for any tok".

E add say, "No negotiation about Ukraine witout Ukraine."

Healey still tok say new plans go soon show for how Nato go support Ukraine, plus billions for new firepower for Ukrainian soldiers wey dey for frontline.

"We wan make peace last, and make wahala and aggression no return," im tok. "Make we no forget say Russia still be threat well beyond Ukraine."

One Ukrainian MP don tell BBC say dem "dey worried" about Donald Trump conversation wit Russian President Vladimir Putin, because "if Putin no dey isolated again, e go make am be like say Putin really want peace".

"How we go take know say Putin really want peace and wan negotiate?" Kira Rudik ask as she tok for BBC Radio 5 Live Breakfast. "And who or wetin go make sure say Putin go keep im own part of di agreement?"

Wen dem ask am weda Ukraine fit eva agree to give up land to Russia, Rudik tok say, "we no go eva give up our territories".

"But," she add, "as President Zelensky don tok, we fit delay our goal to collect dem back".

Wen dem ask am if she fit imagine di day wey Ukrainian president go sit down for negotiating table with Putin, Rudik tok say, "e no suppose dey alone for di table... European leaders suppose dey dia, and hopefully President Trump too, otherwise e no go get any result".

Serious fight still dey go on between Ukraine and Russia for almost three years now, but no be di beginning of di mata be dat.

For March 2014, Russia annex Crimea from Ukraine and support pro-Russian separatists wey start fight against Kyiv army for eastern Ukraine.

Den, for February 2022, Russia do full-scale invasion and try seize Kyiv.

Right now, dem don get control of about one-fifth of Ukraine land, mostly for di east and south. Both sides don lose thousands of pipo, most of dem na military personnel.

Ukraine sef don push enta some parts of Russia especially for di Kursk region wey dey north-east of Ukraine as one way to make Russia scata dia forces and reduce pressure for Ukraine troops for eastern side.