Lauren Sánchez wear Dolce & Gabbana haute couture gown while Jeff Bezos place im arm around her while e wear one smart black tuxedo

Wia dis foto come from, Instagram/Reuters

Lauren Sanchez, 55, wear one lace Dolce & Gabbana haute couture gown for her wedding to Amazon founder Jeff Bezos.

Camera capture her dey smile togeda wit Bezos, 61, after di ceremony, for one picture dem post on Instagram.

Reality stars, actors, royals and some ogbonge A-listers travel to Venice for di ogbonge wedding of Amazon founder Jeff Bezos and TV presenter Lauren Sanchez.

Oprah Winfrey, Orlando Bloom, Kylie Jenner and Ivanka Trump be some of di celebrities wey camera catch for boats and streets of di Italian city on Thursday and Friday.

Di ceremony dey expected to last three days, ending with one big party for di married couple and dia hundreds of guests on Saturday.

Di event bin attract protests from some groups for Venice, including locals wey fight over-tourism to climate change activists.

An estimated 200 pipo bin dey invited to Friday ceremony on di small island of San Giorgio, wia Matteo Bocelli - son of Italian tenor Andrea Bocelli - perform according to reports.

While di exact cost of di wedding no dey known, di estimates range from $20m (£14m) to more dan $50m.

Oprah Winfrey for Venice, Italy, for di wedding of Jeff Bezos and Lauren Sanchez. Oprah wear burgundy dress and white print. Her hair dey styled in loose waves.

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Oprah Winfrey

Kim Kardashian for Venice, Italy, for di wedding of Jeff Bezos and Lauren Sanchez. She dey point her index finger give pesin as she dey talk.

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Kim Kardashian

Kylie Jenner and Kendall Jenner for Venice, Italy, for di wedding of Jeff Bezos and Lauren Sanchez. Kendall wear one floral print dress and Kylie wearing a yellow dress.

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Kendall Jenner and Kylie Jenner

Jeff Bezos wear dark glasses and tuxedo as e wave from di back of a small motor boat for Venice on 27 June 2025.

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Jeff Bezos wave from one small motor boat

Pipo point dia cameras toward Jeff Bezos (not pictured) and guests, as dem spot dem from one boat for Venice.

Wia dis foto come from, EPA

Wetin we call dis foto, Pipo spot Jeff Bezos on im way to San Giorgio island for Venice

General view of Venice, Italy, during di wedding of Jeff Bezos and Lauren Sanchez. Gondolas dey dis picture ontop di water.

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Pipo don travel on Venice canals for hundreds of years

Khloé Kardashian and Kris Jenner for Venice, Italy, for di wedding of Jeff Bezos and Lauren Sanchez. Khloe wear sleeveless black dress and Kris wear a leopard print dress.

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Khloe Kardashian and Kris Jenner

US singer-songwriter Usher Raymond IV (L) with American football star Tom Brady - Usher wear a grey check suit and black bow tie, Brady wear a black suit, dark navy tie and dark glasses, and both dey inside boat.

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, US singer-songwriter Usher with American football star Tom Brady

Activists dey protest for Venice, Italy, against tdi wedding of Jeff Bezos and Lauren Sanchez. Dem hold posters wey say "We be di 99% We get di power".

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Activists wey protest for Venice

Activists dey protest for Venice, Italy, against di wedding of Jeff Bezos and Lauren Sanchez. One protester carry flag for di pictured as e try to climb column.

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Protesters bin try to cause disruption

US manager Corey Gamble and US television personality Kris Jenner for Venice, Italy, for di wedding of Jeff Bezos and Lauren Sanchez. Both of dem wear black outfits and sunglasses.

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Corey Gamble and Kris Jenner

Kris Jenner, Khloe Kardashian and Kim Kardashian for Venice, Italy, for di wedding of Jeff Bezos and Lauren Sanchez. Dem do di peace signs ontop a taxi boat while dia mother Kris Jenner take dia pictures.

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Khloe Kardashian and Kim Kardashian

Edward Enninful and Vittoria Ceretti for Venice, Italy, for di wedding of Jeff Bezos and Lauren Sanchez. Edward wearing one bright white suit and Vittoria wear a pastel pink coloured gown.

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Fashion magazine editor Edward Enninful and Italian model Vittoria Ceretti

US tech entrepreneur Bill Gates and im partner Paula Hurd for Venice, Italy, for di wedding of Jeff Bezos and Lauren Sanchez. Both wearing black outfits.

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, US tech entrepreneur Bill Gates and partner Paula Hurd

US actor Leonardo Dicaprio in Venice, Italy, for di wedding of Jeff Bezos and Lauren Sanchez. E wear a dark baseball cap wey partially cover im face.

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Hollywood actor Leonardo Dicaprio

British actor Orlando Bloom wear white shirt and cream-coloured trousers in Venice, Italy, for di wedding of Jeff Bezos and Lauren Sanchez.

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Actor Orlando Bloom

Ivanka Trump and her husband Jared Kushner in Venice, Italy, for di wedding of Jeff Bezos and Lauren Sanchez. Ivanka wear pink dress and Jared wear suit and bow tie.

Wia dis foto come from, Reuters

Wetin we call dis foto, Jared Kushner and Ivanka Trump, daughter of US President Donald Trump

Amazon founder Jeff Bezos and Lauren Sanchez make sign from di taxi boat for di Aman Hotel for Venice on June 26, 2025.

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Lauren Sanchez and Jeff Bezos inside taxi boat for di city