Iran Israel attack: Trump US go join Israeli strikes against Tehran? - BBC News Pidgin
US President Donald Trump say United States fit join Israeli strikes on Iran and e fit no join, afta series of strikes wey di two sides don launch against each oda.
Di Republican president dey consider to help target di Islamic Republic nuclear facilities, afta a meeting wit im national security advisers for di White House Situation Room on Tuesday.
Trump wey respond to questions on di mata say, Iran get wahala and wan negotiate but Iran reply say dem no go beg for di gates of di White House.
Wen dem ask about if e possible say di US go dey involve for Iran, e reply: "I fit do am, I fit no do am. Nobody sabi wetin I wan do."
Di US president say Iran negotiators suggest say make dem "come to di White House" while e also call for Iran "unconditional surrender"
E say im don already give Iran a 60-day deadline to negotiate a deal wit di US bifor Israel launch dia attack.
Meanwhile, Ayatollah Ali Khamenei say Iran no go surrender.
Iran supreme leader warn Trump of "irreparable harm" if di US join Israeli attacks.
As di crisis continue, Israel say dem still dey hit Iranian targets, including di internal security headquarters, while Iran warn pipo for di Israeli city of Haifa make dem comot sake of say life dey at risk.
Wit counter-attacks expected "in di immediate future", Israel bin declare state of emergency.
Dem kill Hossein Salami, chief of Iran Islamic Revolutionary Guards - wey be powerful branch of kontri armed forces, Iranian state media report, as well as nuclear scientists.
Di US say dem no dey involved for di strikes wey also hit Iran main nuclear enrichment facility dat time, but now, US govment say dem go decide if dem go join or not.
Earlier on Tuesday, Vice-President JD Vance suggest say di US fit intervene to support Israel campaign as e write on social media say Trump "fit decide say e need to take further action" to end Iran nuclear programme for Tehran.
Tehran dey run two principal underground enrichment sites- Israel don hit Natanz and Fordo dey buried deep within a mountain complex near di city of Qom.
According to wetin two senior Western military officers tell BBC Verify, to penetrate di facility, di US go likely get to use GBU-57A/B Massive Ordnance Penetrator (MOP) munitions.
Sabi pipo say one potential target for di US na di Iran Fordo nuclear facility wey dey deep underground and only di US get 30,000lb bomb wey fit destroy am.
On di oda hand, a former Israeli ambassador to di US say im dey fear say Iran fit force Washington hand by attacking a US ship or base to drag dem into di war.
Michael Oren say e get some pipo for di White House wey no wan see di US enta anoda war for di Middle East.
Na least 30 US military planes don move from bases for America to Europe ova di past three days, according to flight tracking data wey di BBC Verify review.
Di planes in question na all US military tanker aircraft wey dem dey use re-fuel fighter jets and bombers.
According to Flightradar24, at least seven of dis planes- all KC-135s - bin stop off for US airbases for Spain, Scotland and England.
DI flights dey come as Israel and Iran continue to exchange strikes, afta Israel launch operation on Friday wey dem say na to destroy Tehran nuclear programme.
Di seven jets wey BBC Verify track don travel and according to flight tracking data, dem dey fly for east of Sicily on Tuesday afternoon.
Meanwhile, six no get any stated destination as one land for di Greek island of Crete.
Di US don also move F-16, F-22 and F-35 fighter jets to bases for di Middle East, according to wetin three defence officials tell Reuters on Tuesday.
As at now, Iran don fire missiles on Israel for di new wave of strikes, according to wetin Iranian state media report and dem add say di missiles don successfully penetrate into di Israeli defences.
Di Israeli military neva acknowledge any strike, but also say dem don launch dia own missiles to hit Iranian missile site.