Faith Kipyegon race: Olympic champion attempt to make history as first woman to run one mile under four minutes - BBC News Pidgin
Wia dis foto come from, Getty Images
Three-time Olympic 1500m champion Faith Kipyegon dey attempt to become di first woman to run a sub-four minute mile.
Di 31-year-old Kenyan dey make di attempt on Thursday 26 June for Paris.
But dis attempt no go dey recognised as an official world record under World Athletics rules as e no be official race.
She go use a team of rotating pacemakers, trainers wey get advanced technology and oda kits from her sponsor.
Faith get faith say she fit copy Sir Roger Bannister, wey first do am for 1954.
Na Kipyegon bin set di current official women mile world record of four minutes 7.64 seconds for 2023, she go need to do more dan seven seconds to achieve di goal.
For Faith, dis new attempt for di sub-four minute mile na her dream outside di box.
"I be three-time Olympic champion. I achieve World Championship titles. I dey tink, 'wat else?', why not dream outside di box?" Kipyegon tok.
"I wan make dis attempt to say women, 'you fit dream and make your dreams valid'."
Di sub-four minute mile na to run a mile under four minutes. A mile na 1609 meters, wey dey more dan four full laps around a 400-meter track. Faith go need to run approximately 2 seconds faster per lap to break di 4-minute record.
Roger Bannister na di first pesin to break di four minute barrier for May 1954.
Since dat time, na ova 2,000 pipo don attempt am - but all of dem na men.
To fit able to run a sub-four mile, di athlete go need to dey capable of running di 800m.
Wen Kipyegon go run for dis attempt, she go get a team of pacers wey go surround her to block out di wind and make her run faster.
Meanwhile, previously one woman Diane Leather become di first woman to run sub-five minutes for 1954.
Also, for October 2019, Kipyegon fellow Kenyan Eliud Kipchoge become di first person to run a marathon in under two hours, but e no dey recognised as di official marathon world record becos e no be open competition.
Wia dis foto come from, Getty Images
Kipyegon na middle-distance runner and she become di first woman to win 1500m gold for three successive Olympics wit her success for Paris last year.
She also get three World 1500m titles and win 5,000m gold for di 2023 World Championships.
Five of di gold medals wey she don win na afta she bin give birth to her daughter Alyn for 2018.
Faith Kipyegon set 1500m title Olympic record for Tokyo afta she first win am for Rio de Janeiro for 2016.
Di Kenyan dedicate some of her win to her three-year-old daughter, wey she credit wit giving her extra motivation afta she take 21-month break from sport.
Her dedication dey more significant to her as she bin di only di third athlete to retain her Olympic title afta she born between Games (along wit Australia Shirley Strickland, for 1956, and Cameroon Francoise Mbango, for 2008).
Kipyegon bin don set world-leading time of 3:51.07 bifor, wey be di fourth fastest time in history.
She get Olympic record, and also di world record.