Europe heatwave temperatures: How heatwave grip UK, Spain, Italy, Portugal, France and oda parts of Europe - BBC News Pidgin
Wia dis foto come from, EPA
Two pipo don die for Italy as temperatures continue to rise. Both Portugal and Spain record dia hottest June ever as hot temperatures continue to grip Europe.
UK also record dia hottest day of di year. Met Office tok say dem record a temperature of 33.6C for Frittenden, Kent.
Spain national weather service Aemet tok say di kontri "extremely hot" June 2025 "don break records", wey surpass di normal average for July and August.
Di Portuguese meteorological service say 46.6C na di highest temperature dem record for June.
Elsewhere on di continent on Tuesday, 1 July, authorities evacuate tens of thousands of pipo sake of wildfires for western Turkey, while two die for Italy following separate heat-related deaths.
Skip Di one wey oda users dey read well well and continue reading
End of Di one wey oda users dey read well well
Wia dis foto come from, Getty Images
Overnight, di Aemet meteorological agency say several places across di Iberian Peninsula don top 43C but add say di temperature fit come down on Thursday.
Night-time temperatures dem record overnight into Tuesday hit 28C for Seville and 27C for Barcelona.
For Turkey, rescuers bin evacuate more dan 50,000 pipo - mostly from di western province of Izmir - as firefighters continue to put out hundreds of wildfires wey break out in recent days.
Fires don also sweep through parts of Bilecik, Hatay, Sakarya, and Manisa provinces.
Forestry Minister Ibrahim Yumakli tok say ova di past three days, emergency teams don respond to 263 wildfires nationwide.
For France, many cities bin experience dia hottest night and day on record for June on Monday, but forecasters tok say di heatwave dey expected to peak on Tuesday.
Dem close di top of di Eiffel Tower for Paris has been sake of di intense European heatwave; while Climate Minister Agnès Pannier-Runacher call am "unprecedented" situation.
For di first time in five years, di Paris region bin activate a red alert, along wit 15 oda French regions. Di Ministry of Education say dem go partially or completely close 1,350 public schools on Tuesday.
Mora for Portugal bin record 46.6 C (115.9F), about 60 miles east of Lisbon on Sunday. Portuguese weather officials dey work to confam if new record go break for June.
Wia dis foto come from, PA Media
For Italy, di Tuscany region don see rise for di number of pipo wey dey hospital admissions by 20%, according to local reports.
Italians for 21 out of di 27 cities don dey subjected to di highest heat alert. Authorities don advise 13 regions, wey include Lombardy and Emilia, say make dem no go outside during di hottest periods of di day.
For Lombardy, dem don ban working outdoors from 12:30 to 16:00 on hot days on building sites, roads and farms until September.
Temperatures for Greece don dey approach 40C for several days and wildfires hit several coastal towns near di capital Athens dey destroy homes and dat dey force pipo to evacuate.
Wia dis foto come from, Getty Images
England don experience dia warmest June on record, Met Office announce on Tuesday, while di UK has a whole see di second warmest June since records start for 1884.
For England, mean temperature of 16.9C set one new record for di hottest temperature experienced for di month of June.
According to provisional data, di Met Office say di whole of di UK mean temperature of 15.2C na di second highest on record for June.
Met Office add: "Average daily maximum temperatures also dey well-above di long-term meteorological average for June, wit England recording dia third highest and UK dia sixth highest average temperature since 1884."
For Germany, di kontri meteorological service warn say di temperatures fit reach almost 38C on Tuesday and Wednesday - further potentially record-breaking temperatures.
Di heatwave go down for Rhine River - one major shipping route – wey reduce di amount cargo ships wey fit transport and raising freighting costs.
Kontris in and around di Balkans also dey struggle wit di intense heat, although temperatures don begin cool. Dem also report wildfires for Montenegro.
While di heatwave na potential health issue, e also dey impact di environment. Higher temperatures for di Adriatic Sea dey encourage invasive species like di poisonous lionfish, e also dey cause further stress on alpine glaciers wey already dey shrink at record rates.
UN human rights chief, Volker Turk, bin sama warning on Monday say di heatwave don highlight di need for climate adaptation.
"Rising temperatures, rising seas, floods, droughts, and wildfires threaten our rights to life, to health, to a clean, healthy and sustainable environment, and much more," e tell di UN Human Rights Council.
Heatwaves dey become more common due to human-caused climate change, according to di UN Intergovernmental Panel on Climate Change.
Extreme hot weather go continue to happun – and go become even more intense - as di planet continue to warm, e tok.
Richard Allan, Professor of Climate Science for di University of Reading for UK, explain say di rising greenhouse gas levels dey make am harder for di planet to lose excess heat.
"Di warmer, thirstier atmosphere dey more effective at drying soils, wey mean say heatwaves dey intensify, wit moderate heat events now becoming extreme."
Wia dis foto come from, Reuters
Wia dis foto come from, EPA
Wia dis foto come from, Reuters