Di coming of ADC don mark di end of PDP?
Leadership of Nigeria's PDP
Di wave of di new opposition coalition for Nigeria politics now still dey very strong as di movement dey gather more steam and more members dey join.
Many Nigerians on social media don describe di joinbodi as a masterstroke move by di opposition, but some political sabi pipo say di ruling party still dey hold plenty aces for dis card game.
However, di kwesion wey some pipo dey ask be say, shey dis coalition go be di beginning of end for di Peoples Democratic Party (PDP)?
Bashir Ahmad, a former tok-tok pesin for former President Muhammadu Buhari, tok say PDP don dey buried as dis ADC movement happen.
Also, Deji Adeyanju wey be lawyer and activist make similar comments as e say "PDP don finally die".
Di PDP na bifor-bifor largest political party for Africa. Between 1999 and 2015 di party bin hold sway and one of dia former National Chairman - Vincent Ogbulafor -even boast in 2008 say dem go rule Nigeria for 60 years.
But only less dan 10 years afta dem comot for power, di party don drown by internal crisis, and pipo say dis joinbodi movement wit di African Democratic Congress na di last straw wey go break di camel back for PDP. But na true?
In all honesty, the once largest party in Africa, the PDP, has now been laid to rest. Their governors are trooping into our party, while their key leaders have pitched their tent with the ADC. (shegiyar uwa)
— Bashir Ahmad, OON (@BashirAhmaad) July 2, 2025
Kabiru Danladi, a lecturer for Ahmadu Bello University, Zaria, tok say PDP don stop to function as a viable political party, wetin dey move around na im carcass.
"Today, wetin remain of di PDP na just patchwork of political actors wey dey retreat. Guvnors dey defect. Dia 2023 vice-presidential candidate (Ifeanyi Okowa) don walk away. State-level structures dey hollow. Internal leadership don fracture, and dem no get any unifying idea to rally around. Wetin all of dis dey tell us? Di PDP no dey for decline. E don dey defunct," oga Kabiru tok for im opinion piece in April.
'Institutions no dey die'
BBC Pidgin ask dis question to Kola Ologbondiyan wey be di bifor-bifor tok-tok pesin for di PDP and e ansa in one sentence say: "Di PDP na strong institution, and institutions no dey die."
Oga Olagbondiyan explain say di party fit dey wounded sake of di big big names wey don comot, but dem still get strong members wey fit hold di party strong if dem fix dia internal wahala.
True-true, of all di pipo wey join di coalition from di PDP, no sitting guvnor dey dia, and for Nigeria politics, guvnors get ogbonge power.
Di PDP guvnors forum bin don agree say dem no go join any coalition or merger, rada dem go welcome any party wey wan come join dem to wrestle power from APC.
But since dem make dat decision for April dis year, dem don lose two of dia members - di govnors of Delta and Akwa Ibom States - to di APC, and rumour dey fly say two more PDP guvnors dey for door dey wait to comot.
Also, ogbonge PDP oga for Lagos State, Bode George, tok for one TV interview say "di pipo wey think say PDP don die na dreamers".
According to oga George, di PDP be like Iroko tree wey be say even if di body fit look dry, "di root stil dey deep and intact".
Wetin need to happen na for di members of di party to "come back, close di door, speak some home truths, debate, and unite".
Lekan Ige, a political sabi pesin and journalist, agree wit wetin oga Bode George tok.
Ige tell BBC Pidgin say di PDP don dey too entrenched for di Nigeria political atmosphere to just die like dat.
"Dem still get guvnors, senators, House of Rep members for both di national and state assemblies for di platform, so di party still dey viable," e tok.
However, Ige say di PDP must to try to resolve dia inside wahala for dia coming convention.
Di tenure of di PDP Acting National Chairman Umar Damagum go expire by di end of di year and di party suppose hold convention to appoint new executives ahead of di election season in 2026/2027.
"Seventy-five percent of di internal problem wey di PDP dey face now go dey solved if dem hold di convention. So dem must try dia best to do di convention, elect new leaders, and from dia, I dey sure say dem go fit pick up di pieces of wetin remain for di party" Lekan Ige tok.