Aminu Dantata: Nigeria businessman die at di age of 94 - BBC News Pidgin
One Nigeria ogbonge businessman and philanthropist, Aminu Dantata, don die at di di age of 94.
Na im Principal Private Secretary, Mustapha Abdullahi Junaid, announce im death for Facebook.
Junaid say, "na wit heavy heart I announce di passing of our beloved father, Alhaji Aminu Alhassan Dantata.
"May Allah grant am Jannatul Firdaus and forgive im shortcomings," Junaid write.
Im add say dem go share di details of im burial later.
Tori be say e die for Dubai early on Saturday morning.
Aminu Dantata na di last surviving son of one of di richest Nigerians for Africa Alhassan Dantata.
During colonial era, Alhassan Dantata bin do plenty business wit very big British companies wey make am blow for Africa.
Dem born Aminu Dantata for 19 May 1931 for Kano.
Oga Aminu bin be very popular pesin for Nigeria business for many many years and im help develop di kontri private sector.
Im na di founder of Express Petroleum & Gas Company Ltd and one of di organisers of Jaiz Bank.
E bin be di head of one group of companies wey dey manage im real estate plus oda business dem.
Di Nigerian businessman bin also be philanthropist. Im follow promote Kano State Foundation, one endowment fund wey dey support education and small businesses for di state.
Aminu Dantata na uncle to Aliko Dangote, wey now be di richest man for Nigeria and Africa.
Im get seven children and many grandchildren. Among im pikin dem na Alhaji Tajuddeen Aminu Dantata.
Nigerians dey mourn di death of Dantata as many of dem enta social media to express dia condolence.
Some of di big Nigerians bin also express sadness on di death of di obonge businessman.
Isa Pantami, former Nigeria minister for Digital Economy, express im condolence, and describe di elder statesman as "complete gentleman, wey dem sabi humility, religiosity, and philanthropy."
Former Nigeria Senator, Shehu Sani, say di death of Oga Dantata na "great loss to di kontri." E add say: "No be everyone dey dey so blessed wit combination of purposeful longevity, generous spirit and wealth of honour. Im be accomplished man wey live exemplary life."
Di tenth Senate President of di Nigeria Senate, Bukola Saraki, say Dantata death "mark di end of an era defined by principled leadership and a lifelong devotion to service."
Saraki describe am as man wey no just live life, but man wey invest im life "in di growth of Nigeria and di upliftment of all im pipo, regarless of wia dem from come."
Di Northern Govnors Forum through dia chairman, Govnor of Gombe State, Muhammadu Yahaya, describe di death of di Kano-born businessman as "end of a remarkable era. An era defined by visionary enterprise, uncommon generosity, rare humility and integrity."