Which teams go through for Champions League - and who go play who next? - BBC News Pidgin
Wia dis foto come from, Getty Images
Four teams go through to di quarter-finals of di Champions League as half of di last-16 ties don complete.
Paris St-Germain beat Premier League leaders Liverpool on penalties on Tuesday afta dia 1-1 aggregate draw, while Barcelona, Bayern Munich and Inter Milan join dem for di last eight, di rounds wey remain for di second legs go take place on Wednesday, 12 March.
Who go face who for di last eight? We go break am down for una.
Barcelona beat Benfica 4-1 on aggregate
Bayern Munich beat Bayer Leverkusen 5-0 on aggregate
Inter Milan beat Feyenoord 4-1 on aggregate
Paris St-Germain beat Liverpool 4-1 on penalties after 1-1 aggregate draw
Lille v Borussia Dortmund (1-1 on agg) - Second leg: 12 March (18:45)
Aston Villa v Club Brugge (3-1 on agg) - Second leg: 12 March (21:00)
Atletico Madrid v Real Madrid (1-2 on agg) - Second leg: 12 March (21:00)
Arsenal v PSV (7-1 on agg) - Second leg: 12 March (21:00)
Liverpool suffer dia first setback under manager Arne Slot afta PSG beat dem 4-1 on penalties for Anfield.
Di French champions bin look like say dem go comot for di competition for di league phase bifor dem pick form wey see dem finish15th for table, and now wey dem enta knock phase dia form hot well-well.
PSG go most likely face Aston Villa for di quarter-finals for April, di 1982 European Cup winners get upper hand against Club Brugge.
Villa go host di second-leg tie on Wednesday afta dem win 3-1 for Belgium, while fellow English Premier League side Arsenal don almost go through afta dem thrash PSV 7-1 for di first leg.
Di first leg of di quarter-finals go take place on 8 and 9 April, while di second leg go take place one week later.
Di semi-finals go den take take place on 29 and 30 April for di first legs, wit di return fixtures on 6 and 7 May.
Di final go take place on 31 May for Allianz Arena for Munich.
Each kontri league go earn one coefficient ranking based on how dia teams perform for Uefa three men club competitions: dat na di Champions League, Europa League and Conference League.
Dem go get Coefficient points through match results - two for a win and one for a draw.
Di points wey clubs from di same domestic league get dem go add am upand divide by di number of clubs di league get for Europe.
For example, if di Premier League get 100 points, dem go split am by di number of teams wey dey play for Europe (seven), e go give England a coefficient of 14.28.
Dis season, bonus points dey available to clubs wey dey play for Champions League, dis na advantage to leagues wey get more clubs wey dey compete for di competition, like Germany and Italy.
kontris wey finish for di top two of di coefficient table' go earn an additional Champions League spot for di following season.
Those spots dey awarded to di teams wey finish for first position below di standard Champions League allocation for those leagues.
For Premier League, di top four clubs automatically qualify for di Champions League via league position, so any additional place go, go to di team wey dey fifth.
Additional spots for di 2024-25 Champions League go to Bologna and Borussia Dortmund, wey finish fifth for Serie A and di Bundesliga respectively.
England dey top di coefficient table, despite say Liverpool don follow Manchester City comot for Champions League.
Italy dey second but dem bin get bad run for February wen AC Milan, Atalanta and Juventus all lose for di knockout play-off round - dis don limit Serie A opportunity to gada more points.
Spain dey third for di rankings, but Germany prospects dey difficult sake of say Bayern Munich and Dortmund dey di same half of di Champions League draw.
Na di same wit France. Paris St-Germain and Lille na di representatives wey still remain for Champions League, afta Monaco and Brest exit for play-off stage.
Lyon dey Europa League, dem be di only oda French side wey still dey European competition.
England fit end up wit seven Champions League teams next season.
Di winners of di Europa League, as well as di Champions League, dem dey give dem a spot.
Under previous rules, any single league fit only get a maximum of five clubs for Champions League. But dat rule, dem don scrap am.
Dis season, any team wey win di Europa League or Champions League but no qualify for di Champions League through dia domestic league position go enta di Champions League.
Dis don raise di possibility of Manchester United or Tottenham, wey both of dem dey through to di knockout stage of di Europa League but dey di bottom half of di Premier League, dem fit qualify for di Champions League alongside di top four or five.