Ange Postecoglou and Ruben Amorim

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Ange Postecoglou or Ruben Amorim go win dia first European trophy on Wednesday?

E neva happun for di history of any European competition bifor, wey two teams wey no dey in-form at all go play final.

Di winners of di Europa League final between Manchester United and Tottenham for Bilbao on Wednesday fit be di lowest league finishers eva to win a major European trophy.

And dem go certainly become di lowest team to eva qualify for di European Cup or Champions League.

Manchester United dey 16th position for di Premier League, while Tottenham Hotspur dey follow dem for back for 17th.

Di two clubs and Europa league finalists get a combined 39 league defeats.

Di only league games wey di two teams bin win na since 2 February and na against clubs wey don relegate- or each oda.

Di points tally wey di two of dem get suppose carry dem go relegation for previous seasons.

"I no rememba any game wey dey put both teams under pressure like dis," na wetin former Celtic striker Chris Sutton tok for BBC Radio 5 Live's Monday Night Club.

And yet one of dem go celebrate glory - and dem go return to di riches of di Champions League next season.

Wetin we call dis Video, Win or lose, Postecoglou fit still manage Spurs next season?

BBC Sport senior football correspondent Sami Mokbel and chief football news reporter Simon Stone, wey go dey for San Mames for di final, don tok about who get di worse season between di two clubs.

Mokbel on Spurs: "Underperformed, underachieved, unacceptable. Locally, at least.

"While Tottenham dey hold on to di hope wey fit turn to dia catastrophic season into a historic one somehow, dem no go fit run away from di fact say results and performances dem dey largely disastrous.

"Twenty-one defeats for di Premier League and counting. Of course, dem go forget am if Spurs lift di Europa League trophy on Wednesday night.

"Weda e dey enof to keep Ange Postecoglou for im job, however, na di million-dollar question wit all di indications wey dey point towards di Australian so im go comot from di club no mata di outcome for Bilbao.

"Di fact say Postecoglou tenure for north London look like say e don dey set to end just show how pitiful dia domestic campaign be.

"For dia defence, injuries scata Tottenham season. Dem lose key players for long periods of time.

"But dis na expensively-assembled Tottenham squad - di one wey include di club-record £65m signing of Dominic Solanke.

"United dey for a season of transition, dem bin change managers midway thru di season.

"E dey different for Tottenham. Sake of Postecoglou encouraging first season in charge, wey Spurs bin finish fifth, dis na team wey dem bin set up to compete for Champions League qualification.

"Instead, dem fit finish one place above di relegation zone. E dey veri poor and dem no go deny am."

Stone on United: "Manchester United don dey worse becos na dem cause much of di damage by diasef.

"Na United wey bin reflect on Erik ten Hag tenure, afta dia 4-0 defeat for Crystal Palace last May, den afta di FA Cup final victory ova Manchester City, and dem bin decide to kontinu wit am.

"United bin give am money to spend, specifically on Matthijs de Ligt and Joshua Zirkzee for di summer, den sack am afta nine games.

"And United bin tell Ruben Amorim say im need to start sharp-sharp, make im no wait until di summer to join from Sporting.

"Now, di safety net na Bilbao and United must hit di ground running for di start of next season, wey go justify di refusal to wait for Amorim.

"But, as e be hia and now, United have been woeful.

"Periods bin dey for di games wen dem bin look like say dem dey play well and dia passing triangles bin work.

"However, Rasmus Hojlund no look like a threat for one end of di field and basic mistakes don undermined dem for di oda end.

"Wit six minutes of extra time wey bin remain for dia Europa League quarter-final against 10-man Lyon, e bin no dey easy to strike one single optimistic note on United behalf. Somehow, dem manage to rescue demsefs.

"Since den, United don get one point from five Premier League games. No-body don perform worse dan dat.

"By any measure, dis na United worst season since di 1973-74 relegation campaign. And dem bin announce financial losses of £113.2m last September.

"To spend so much and to dey so bad really take some doing."

Only two teams bin don win European trophy afta dem finish below 12th for dia domestic league.

Di teams include di old Inter-Cities Fairs Cup, European Cup Winners' Cup, Uefa Cup, European Cup, Champions League, Europa League and newish Conference League.

Di lowest-ranked team yet na West Ham just two seasons ago wen dem bin finish 14th for di Premier League but dem bin win di third-tier Conference League.

Di highest Manchester United or Spurs fit finish na 14th - wit several results wey go dia way.

All di oda lowest finishes bin come from various repeated process of di Europa League.

Inter Milan bin finish 13th out of 18 teams for Serie A in 1993-94, dem bin only stay up by one point (for di old system of two points for a win), but dem bin win di Uefa Cup.

A team wey finish 12th bin don win am three times - Arsenal for di 1969-70 Inter-Cities Fairs Cup, Schalke for di 1996-97 Uefa Cup and Sevilla for di 2022-23 Europa League.

Sevilla team na di lowest-placed wey don eva qualify for di European Cup or Champions League - until now.

Former Chelsea player Sutton say: "Di match no go get beta quality to display.

"Di two set of players go dey apprehensive and nervous."

Weda Amorim and Postecoglou go make changes for recent Premier League games, im add say: "I no understand why fear dey catch dem. Both managers wan go into di cup final wit momentum.

"And e go really add to di occasion and di pressure."

Dis na di sixth all-English final for European competition - with all of wey bin involve either Tottenham or Chelsea.

England na di first kontri to get so many Uefa competition (excluding di Inter-Cities Fairs Cup).

Tottenham bin beat Wolves for di 1972 Uefa Cup final and Manchester United bin also defeat Chelsea to win di 2008 Champions League.

For 2019, both finals na all-English - and Liverpool bin beat Tottenham for di Champions League and Chelsea see off Arsenal for di Europa League.

Chelsea beat Manchester City to win di Champions League for 2021.

List of all-English finals

Both managers dey looking for dia first trophy in charge of an English club - but dem bin don win silverware abroad.

Postecoglou, 59, get di bigger trophy haul, even though im bin don dey manage for a longer time dan im 40-year-old opposite number.

Ange Postecoglou and Ruben Amorim record for finals. Postecoglou bin don win 5 out of 6, Amorim bin win 3 out of 5

Wetin we call dis foto, Super Cups, finals to decide di Australian league champions - plus di ones wit Australia youth teams no follow for hia

Both sides go dey desperate to win dis match, but dia aim dey clear.

For Tottenham, e go be dia first trophy since di 2008 Carabao Cup and dia first European trophy since 1984.

And somehow dia worst domestic season since di 1970s fit turn out to be dia best for years.

"I dey sure say if e happun on Wednesday night Ange go dey proud as e dey waka comot from di pitch and say 'see you later, I bin don tell you wetin I go do mate'," na wetin di former Republic of Ireland goalkeeper Shay Given tok.

Sutton add say if Spurs lose, Postecoglou fit no even dey in charge for di final game of di Premier League season at home to Brighton on Sunday.

"If Postecoglou win dem go hail am," di former Blackburn forward tok "But just imagine di atmosphere against Brighton if Tottenham lose.

"I suspect say im fit no dey in charge if e happun becos e go dey as toxic as anytin."

For Manchester United - wey bin don win two domestic cups for di past two seasons - Champions League qualification na di ultimate goal for hia.

"Financially, na di most important match for di club history," football finance expert Kieran Maguire tok.

Sutton feel say di game na a potential "get-out-of-jail-free card" for Amorim.

Di Portuguese, wey dey hope to oversee a summer rebuild, say: "I tink [qualifying for di] Champions League dey more important for evritin, to prepare di next season.

"We suppose to dey for di Champions League and di Europa League hia no dey enough, you get dat feeling hia. Di best way to help us get to di top in a few years na di Champions League."