Wetin we call dis Video, Watch: Moment activists say Israel stop dia boat

Israeli authorities board and seize one boat wey bin dey try to bring humanitarian aid to di Gaza Strip and detain di activists wey involve.

The Madleen yacht - get climate activist Greta Thunberg inside - and e now dey on im way to Ashdod, wey be port city around 27km (16.7 miles) north of Gaza, according to Israeli media.

Dem bin dey try to bring small quantity of humanitarian aid to di Gaza Strip against one Israeli naval blockade.

Earlier, Israel foreign ministry bin say di yacht dey "safely make im way to di shores of Israel" and im passengers dey "expected to return to dia home countries".

Di Palestinian foreign ministry don call for protection of di activists safety.

Dis photo according to reports wey dem post on Telegram show activists with dia hands up inside di Madleen

Wia dis foto come from, Freedom Flotilla Coalition

Wetin we call dis foto, Reports say dis photo dem post on Telegram show activists with dia hands up inside di Madleen

Dem share photos of soldiers as dem dey give sandwich and water bottles to di activists.

"Connection don dey lost" on di Madleen, di Freedom Flotilla Coalition (FFC) campaign group tok for di Telegram app. Dem post one photo wey show pipo wey wear life jackets sitting with dia hands up.

Israel say im blockade on Gaza dey necessary to prevent weapons from reaching Hamas militants for Gaza.

After reporting say di yacht don dey boarded, FFC post short, pre-recorded videos of some of di activists, including Thunberg.

For di footage, activists say "if you see dis video di Israeli military or forces wey dey support dem don don stop and kidnap us".

Activists inside di Madleen yacht

Wia dis foto come from, Freedom Flotilla Coalition

Wetin we call dis foto, Activists inside di Madleen

Di FFC argue say di sea blockade dey illegal, dem call Katz statement as an example of Israel threatening di unlawful use of force against civilians and "attempting to justify di violence".

"We no go dey intimidated. Di world dey watch," FFC press officer Hay Sha Wiya tok.

"Di Madleen na civilian vessel, unarmed and sailing for international waters, carrying humanitarian aid and human rights defenders from across di globe... Israel no get right to stop our effort to reach Gaza."

Di Madleen dey carry ogbonge quantity of aid, including rice and baby formula, di group tok.

Citizens of Brazil, France, Germany, the Netherlands, Spain, Sweden and Turkey dey onboard.

The Madleen begin dey sail on 6 June from Sicily wit di goal of reaching Gaza.

Di ship get a crew of 12 pipo, including Swedish climate activist Greta Thunberg, Rima Hassan, one French member of di European Parliament, and Omar Faiad, wey be French journalist with Al Jazeera.

Di remaining members na: Yasemin Acar, Baptiste Andre, Thiago Avila, Pascal Maurieras, Yanis Mhamdi, Suayb Ordu, Sergio Toribio, Mark van Rennes and Reva Viard.

Greta Thunberg

Wia dis foto come from, Reuters

Greta Thunberg, 22, na one of di world best-known climate change campaigners, wey dey credited with raising public awareness - especially among young pipo - about di issue.

For 2018, den at di age of 15, di Swedish national hold di first "School Strike for Climate" outside di parliament for Stockholm. Di protest dey widely covered, and hundreds of thousands of young pipo across di world later join her Fridays For Future strikes.

Ms Thunberg since den do dey arrested several times for her participation for environmental protests around di world, and don also dey fined by di Swedish courts.

Israel recently begin dey allow limited aid to enta Gaza after one three-month land blockade, dem dey prioritise distribution through di Gaza Humanitarian Foundation, wey dey backed by Israel and US but wey dey widely condemned by humanitarian groups.

UN human rights chief, Volker Türk, tok last week say Palestinians dey face terrible choices: die from starvation or risk death while dem dey try to access di small food wey dem dey make available".

But for one post on X early on Monday, Israeli foreign ministry say: "While Greta and odas try to stage one media provocation wey di sole purpose na to gain publicity - and wey include less dan a single truckload of aid - more dan 1,200 aid trucks don enta Gaza from Israel within di past two weeks, and in addition, di Gaza Humanitarian Foundation don distribute close to 11 million meals directly to civilians for Gaza.

"Ways dey to deliver aid to di Gaza Strip - dem no involve Instagram selfies."

Na almost 20 months since wen Israel launch one military campaign for Gaza in response to di Hamas-led cross-border attack on Israel on 7 October 2023, wia about 1,200 pipo dey killed and dem take 251 odas hostage.

At least 54,880 pipo don dey killed for Gaza since, according to di territory Hamas-run health ministry.