Elon Musk fire Trump tax bill: Musk describe Trump tax bill as 'disgusting abomination' - BBC News Pidgin
Wia dis foto come from, Getty Images
Elon Musk don fire President Donald Trump im tax and spending bill, wey im describe am as "disgusting abomination", di latest for di beef between di two.
Di House of Representatives bin pass di budget – wey include multi-trillion dollars for tax breaks and more defence money wia go allow di US goment to borrow more moni, last month.
"Shame for di pipo wia don vote for dis," Musk write on top im X page about di law for Trump im second-term agenda.
Di ogbonge tech billionaire bin resign from di Trump goment last week afta 129 days, wia im bin dey work wit di team wia don dey ensure say goment dey cut cost, wia dem no dey spend plenty.
Di comment na di first time Musk neva gree wit Trump since im comot di goment, afta im bin describe di plan say na "disappointing."
Di tech billionaire wia dem born for South Africa im time for di Trump goment don end for 31 May, even tho Trump tok say "im go always be wit us, helping all di way."
Trump don describe di current bill as di "ogbonge beautiful bill", wey pipo don tok say e go increase di budget deficit; difference between goment wetin di goment don dey spend and wetin e dey get as revenue – by about $600bn (£444bn) for di next fiscal year.
For plenti post for X on Tuesday, Musk tok say "dis bill wey no dey make sense go increase di budget deficit wey already dey high to $2.5 trillion (!!!) wey e go worry America [sic] citizens wit plenti debt."
For America politics, "pork" na to spend moni on top projects for di constituencies of di lawmakers.
Musk don add anoda political warning for im post.
"For November next year, we go fire all politicians wey don betray di American pipo," im write.
Wia dis foto come from, Getty Images
Dem bin ask di white house secretary Karoline Leavitt about wetin Musk bin wrote on top social media, im tok say "di president already sabi Musk im position about dis bill."
"Dis na one ogbonge bill," she don add.
Oga Trump dey "stick to am."
Di law also bin promise to extend di tax cuts wia dem pass for di first Trump goment for 2017, togeda wit moni dem go spend for defence projects and di moni to pay for di mass deportation of immigrants wey no get papers.
Elon Musk im comment don show di tension wey dey between di Republicans ova dis plan, wia different part wings no gree wit, as e pass thru di white house.
Di senate now bin chook mouth for dis mata, wia e already dey scatter pipo for di chamber, wia di Republicans don dey control by slim margin.
Senator for Kentucky - Rand Paul bin tok ova di last few days say im no go support di bill if e dey raise di debt ceiling.
"Di GOP [the Republican Party] go treat di debt like dia own, afta dem, vote for dis," im tok CBS News, di BBC partner for US, ova di weekend.
Trump also don respond to Paul wit plenti social media posts, wia im dey accuse am say im get "small understanding of di bill" wey im add say Kentucky pipo no fit to stand am."
"Im ideas na crazy," Trump write.
Wia dis foto come from, Getty Images
Republican lawmakers bin push back push back afta Musk im comments, na so Senate majority leader John Thune tok journalists say "di party plan to kontinu wit full speed" even tho dem get "different opinion."
"We gat agenda wey everibody bin use to campaign, especially di president," im tok.
Republican Speaker, oga Mike Johnson wey bin lead dis law thru di House tok reporters for capitol Hill say "dat my friend Elon na dey terribly wrong."
"Na very important way to start. Elon don dey miss di point," Johnson tok.
Johnson tok say im bin dey on phone for 20 minutes wit di tycoon about di bill on Monday, wia im add say e go gradually remove di electric vehicle tax credits, wia e fit "get effect" on Tesla, Musk im company.
Among di tins wia vex oga Musk na air traffic control for di federal aviation administration (FAA), according to Axios.
Musk bin dey hope say e go run on top im Starlink satellite system, but dem don deny am sake of wahala about di technology and wetin be conflict of interest, according to sabi pipo.
Some Democrats bin welcome Musk im comments even tho dem don blast am and di work im do wit Doge, di time im dey part of di Trump goment.
"Even Elon Musk, wey be part of di whole process, wia im na trump im friend, tok say di bill na bad," Senate Minority Leader Chuck Schumer tok. "We fit only imagine how bad dis bill be."
Trump and Republicans for Congress don set 4 July deadline to measure di law wia dem pass.
Musk support Trump for di last November election wit donation of more than $250m.
To make peace wit spending hawks, Trump also bin dey ask Congress to pass one plan wey go reduce di current spending by $9.4bn, dis figure na from di work of Doge.
Dis go slash funding for foreign aid, di United states agency for International Development (USAID) and for broadcasters NPR and PBS.