Scene of di crash

Wia dis foto come from, AP

Rescue operation dey go on for di spot very near di airport wia one Air India plane crash.

Di plane wey dey head to London crash small time afta e take-off for Ahmedabad, western India. Di flight bin dey head to London.

Ambulances dey all over di area. Roads dey blocked.

Emergency response teams dey try to quench di fire.

Officials don confam say na 242 passengers and 12 crew members na im dey onboard di Air India plane wey crash.

Faiz Ahmed Kidwai, chief of India directorate of civil aviation, tell di Associated Press say di plane crash inside one residential area called Meghani Nagar.

One spokesperson from Sardar Vallabhbhai Patel International Airport for Ahmedabad say di airport no currently dey operational. All flight operations don dey suspended until further notice.

Air India tok say: "Flight AI171, wey dey operate Ahmedabad-London Gatwick, dey involved in one incident today".

Tori be say di plane bin dey carry more dan 200 passengers.

E be like say e crash for one residential area, BBC South Asia correspondent report.

India aviation minister say "we dey on highest alert", as "rescue teams don dey mobilised".

Flight Radar say di Air India flight bin dey scheduled to fly from Ahmedabad International Airport to London Gatwick Airport at 09:50 local time. Im scheduled arrival time na 18:25 local time.

Di signal bin dey lost at 10:08 local time at 625 feet, less dan a minute after e take off, di flight tracking website tok for X.

Di plane history show say e dey regularly fly between India and destinations including Paris, Frankfurt, Tokyo, Amsterdam, and Melbourne.

Air India aircraft

Wia dis foto come from, Getty Images